Nigeria election 2023: Rabiu Kwankwaso profile

Rabiu Musa Kwankwaso
    • Author, Victor Ezeama
    • Role, BBC News Pidgin, Lagos

Rabiu Musa Kwankwaso, di 66-year-old politician wey dey contest to be Nigeria next president, dey always appear for public with im red cap.

Na symbol of im ambition and im achievements - e be former defence minister, former senator and serve two-terms as govnor of Kano, one of Nigeria most populous states.

Im supporters for Kano wey be part of im Kwankwasiyya movement, wey mean di "Red Cap Revolution" for Hausa, dey also wear di cap.

Dis loyal political fan club don even follow am as e switch parties - in particular im move for 2013 from di den-governing Peoples Democratic Party to di All Progressives Congress, di current ruling party.

Ova im career, e don dey with five parties, and now e be presidential candidate for di New Nigeria People's Party (NNPP), wey pipo no too sabi for di kontri until e join last year.

Analysts say e get little chance to win di election, dis na sake of say im power base strong for north, but e fit cause serious political worries by taking northern votes from Bola Tinubu of APC and Atiku Abubakar, di PDP contender.

To win presidential election, di candidate must show say dem get national support by gaining 25% of votes for two-thirds of di 36 states wey dey Nigeria, plus get di most votes.

Political analyst Chisom Ugbari tell BBC say Kwankwaso go need to make inroads for di south to achieve dis.

At one stage, dem don suggest merger with anoda leading candidate, Peter Obi of Labour Party, wey come from south-east.

Some pipo tok say dis kain alliance go give di chance to wrestling power from di APC.

But for one BBC interview, Kwankwaso say dat no go happun, and tok say di Labour Party candidate no get im political record: "You no fit compare am to me wey don dey in politics for many years."

Achievement for education

However, Ibrahim Sharada, wey be Kwankasiyya and member of NNPP, tink say im candidate fame and influence "stretch beyond northern Nigeria".

And e no get any doubt dat e be one of di four leading candidates and if e enta second round, e fit become king-maker base of im loyal followers for Kano, wia e first become govnor for 1999.

Dis na di year wey mark di end of military rule - and e no dey wear di famous red cap den.

Dis come more dan 10 years later. In fact, e lost im gubernatorial re-election bid for 2003, dat na wen den-President Olusegun Obasanjo make am im defence minister.

Supporters of Rabiu Kwankwaso, wear red caps, ontop cattle campaign cart for Kano state, Nigeria
Wetin we call dis foto, Supporters of Rabiu Kwankwaso wear red cap

E serve for dis role until 2007 for time wey relative peace dey for Nigeria.

One of im main manifesto pledge na to fight di current state of insecurity di kontri dey face - dat na di Islamist militancy for di north, kidnappings, cattle-farmer conflicts and separatist rebellion for di south-east - to boost di army head count to one million by recruiting 750,000 extra personnel.

Afta im time for goment, e return to state politics, wey be wen e form di Kwankwasiyya movement, taking inspiration from di late well-known anti-colonial freedom agitator Malam Aminu Kano, wey become ogbonge politician and social reformer for northern Nigeria afta independence.

Dressed in red cap and flowing white kaftan, e bin dey famous for pointing out di inequalities of wetin be fairly feudal society for di region - fighting for more equality, including di rights of women.

Kwankwasiyya, oga Kwankwaso tok, dey made up of those ideals - and di movement attract young following wey like to dress like dia mentor.

Moving to a second term as govnor, Kwankwaso tok say e deliver on dis ideals in particular through im educational reforms, making education free for all levels to dis day.

However, e dey only available to those wey come from Kano and students need "indigene certificate" to qualify.

Goment school students for Kano, Nigeria - 2019

Wia dis foto come from, AFP

Wetin we call dis foto, Mr Kwankwaso introduce free primary, secondary and tertiary education for Kano

"E declare free education as e enta office and na one of di first govnors across Nigeria to introduce di school feeding programme for indigent pupils," Kano journalist Yinusa Ahmad tell BBC.

"Hundreds of students also get foreign scholarships and now most of dem form di most loyal base of im Kwankwasiyya movement."

During im time as govnor, e say Kano build many schools and invest for teachers, though di UN say di state still get one of di highest numbers of out-of-school children for Nigeria.

Education clearly dey important to Kwankwaso, wey dey soft spoken but dey show plenti confidence and charisma.

E dey successful for school and go on to university, qualifying as a water engineer - get degrees for UK and India.

E return to work for dat sector, mainly for Kano water and engineering agency, before e enta di political side.

Pension allegations

Like many Nigerian politicians, Kwankwaso don face corruption allegations.

For 2021, two years afta e complete one term as senator, di Economic and Financial Crimes Commission (EFCC) question am ova di alleged diversion of pension funds wen e be govnor.

E deny di allegations, and tok say e dey politically motivated, and di case no go any further.

Who dey di race to run tins for Nigeria?

Learn more about Nigeria presidential candidates

Choose a candidate to view dia bio

Bola Tinubu

All Progressives Congress (APC)

  • Age: 70.
  • Im study accounting for Chicago State University.
  • Two-term Lagos State Governor from 1999-2007.
  • Im represent Lagos West for Senate from 1992 to 1993.
  • Na veteran of Nigerian politics, dis na im first presidential bid.
  • Campaigning against military rule.
  • Im grow Lagos State annual revenue by more than four times from N22.2 billion for 1999 to N220.9 billion for 2007.
  • E work as senior auditor and later treasurer of Mobil Producing Nigeria, one of di kontri largest oil producers.
  • Im plan to boost Nigeria export and reduce reliance on imports.
  • Im plan to cut youth unemployment rate in half within four years and create one million jobs for ICT in two years.
  • Reform di justice system to focus on crime prevention and improve trust in security forces.

Atiku Abubakar

Peoples Democratic Party (PDP)

  • Age: 76.
  • Vice President of Nigeria from 1999 – 2007.
  • Im get Master's in international relations from Anglia Ruskin University, UK.
  • Im be former customs officer wey come into politics for early 1980s.
  • Five unsuccessful presidential bids in 1993, 2007, 2011, 2015 and 2019.
  • Im found di American University of Nigeria, wey offer scholarship to freed Chibok girls.
  • Na successful businessman with investments in oil services, agriculture, banking and pharmaceutical sectors.
  • Controversial privatisation of goment assets agenda.
  • Im plan to give private sector greater role in di economy.
  • Reinforce national unity through equity, social justice amongst Nigeria diverse pipo.
  • Im plan to restructure Nigeria governance system.

Peter Obi

Labour Party (LP)

  • Age: 60.
  • Two-term Governor of Anambra State from 2007 to 2014.
  • Na Presidential running mate during di 2019 election.
  • A business man, im study philosophy for University of Nigeria, Nsukka.
  • Im establish sub-sovereign wealth fund wey worth about $156million in dollar-denominated bonds by di end of im tenure as governor.
  • Im move Anambra from 26th to 1st in di ranking of best performing states for NECO and WAEC national examinations.
  • E own chain of retail business wey don create thousands of jobs.
  • Im plan to ensure accountability in governance and fight corruption.
  • Im plan to move Nigeria from consumption to production.
  • Prioritize Human Capital Development through robust investments for STEM education, health, and infrastructural development.

Rabiu Kwankwaso

New Nigeria Peoples Party (NNPP)

  • Age: 66.
  • Minister of Defence from 2003 to 2007.
  • Kano State Governor from 1999 to 2003, and 2011 to 2015.
  • Im represent Madobi Federal Constituency for House of Representatives for 1992 and Kano Central Senatorial District between 2015 and 2019.
  • Im get PhD in civil engineering from Sharda University, India.
  • Scholarship and philanthropic efforts.
  • Im increase di primary school enrolment figures from one million in 2011 to over three million in 2015 wen e leave office.
  • E introduce free school feeding and uniforms for primary school pupils.
  • Im establish Kano University of Science and Technology in Wudil and di Northwest University, wey be Kano first and second state universities.
  • Im plan to create jobs through investment in agriculture.
  • Address insecurity.
  • Respect di rule of law and follow due process.
A roof with Kwankwasiyya emblazoned on it in Kano

Wia dis foto come from, Khaleel Nasir

Wetin we call dis foto, Buildings built during Mr Kwankwaso's second term as governor are emblazoned with the name of his Kwankwasiyya movement

Kwankwaso, wey dey married with six children, display political confidence.

E show dis most recently wen e dismiss need for alliance to win di presidency. E be man wey like to make im own mark - and na sometin wey pipo still fit see all ova Kano city.

All di buildings dem construct during im time as govnor get di "Kwankwasiyya" mark for big capital letters across di roof. E want make nobody forget am.

Nigeria election graphic
Nigeria election graphic