Alaafin of Oyo: Oba Lamidi Adeyemi and five Nigerian traditional rulers wey join dia ancestors recently

Alaafin Oba Adeyemi III

Wia dis foto come from, Alaafin Oba Adeyemi III

Wetin we call dis foto, Alaafin Oba Adeyemi III

Nigerians for home and abroad dey mourn di death of Alaafin of Oyo, Oba Lamidi Adeyemi, wey join im ancestors on Friday 22 April at di age of 83.

Di first class king bin rule for 52 years and nai be di longest reigning Alaafin of Oyo.

Before di death of Oba Adeyemi, Nigeria bin lose some oda traditional rulers and three of dis monarch na from Oyo State, southwest Nigeria.

Olubadan of Ibadan

Oba Lamidi Adeyemi: 5 Nigerian traditional rulers wey join dia ancestors before Alaafin of Oyo

Wia dis foto come from, Facebook

Wetin we call dis foto, Di late Oba Saliu Adetunji

Di Olubadan of Ibadan land Oba Saliu Adetunji Ajeoguguniso I bin join im ancestors on January 2, 2022 at di age of 93 years.

Dis na di most recent first class traditional ruler death before Oba Adeyemi.

Oba Adetunji na di 41st Olubadan of Ibadan for Oyo state, southwest Nigeria.

Na March 14, 2022 dem install anoda Olubadan of Ibadan land, Lekan Balogun, wey be di Otun of Olubadan wen Oba Saliu still dey alive.

Di coronation of di new Olubadan bin happun for Mapo Hall for Ibadan.

Soun of Ogbomoso

Oba Lamidi Adeyemi: 5 Nigerian traditional rulers wey join dia ancestors before Alaafin of Oyo

Wia dis foto come from, Other

Soun of Ogbomoso, Oba Oladunni Oyewumi na anoda first class monarch wey die for Oyo State before di death of Oba Adeyemi.

Di traditional ruler die at di age of 95 on Sunday, 12 December, 2021 afta im rule for 48 years.

Oba Oyewumi na di 20th Soun of Ogbomoso and im become king for 1973.

Dem never install new Soun of Ogbomoso.

Olu of Warri

Oba Lamidi Adeyemi: 5 Nigerian traditional rulers wey join dia ancestors before Alaafin of Oyo

Wia dis foto come from, Other

Wetin we call dis foto, Ogiame (King) Ikenwoli Godfrey Emiko - Ogiame mean "king of di river"

Di 20th Olu of Warri, Ogiame Ikenwoli Godfrey Emiko join im ancestors for 21 December 2020 at di age of 65.

Dem born di king of di Itsekiri pipo of Delta State, south-south Nigeria on 19 March,1955 and e spend six years on di throne.

Dem crown Ikenwoli on di 12th of December 2015 for Ode-Itsekiri, wey be di ancestral home of di Itsekiri pipo.

Di new Olu of Warri na di nephew of di 20th Olu of Warri.

Olowu of Owu

Oba Lamidi Adeyemi: 5 Nigerian traditional rulers wey join dia ancestors before Alaafin of Oyo

Wia dis foto come from, Sun newspaper

Wetin we call dis foto, Olowu of Owu, Oba Olusanya Dosunmu

Olowu of Owu for Ogun State, Oba Olusanya Dosunmu Amororo II bin join im ancestors on 21 December 2021 afta brief illness.

Before im become king, Oba Dosunmu na di producer of di popular Nigerian Television series, Di Village Headmaster wey hold di record as di longest-running popular television series for over 20 years.

Im become king for 2005 afta di death of Oba Adisa Odeleye wey die for 2003.

Oba Dosunmu na di 13th Olowu of Owu.

Asigangan of Igangan

Oba Lamidi Adeyemi: 5 Nigerian traditional rulers wey join dia ancestors before Alaafin of Oyo

Wia dis foto come from, @Oba Igangan

Di Asigangan of Igangan land for Oyo State, Oba Abdul-Azeez Adewuyi, Aribiyan II bin die for 21 December 2021.

Aribiyan II bin join im ancestors at di age of 95 few days afta di death of di Soun of Ogbomoso.