Alaafin of Oyo biography in pictures: Oba Lamidi Adeyemi III and how im live life in fotos

Di Alaafin wey be 83 years old na di longest reigning Alaafin ever afta e rule for 52 years.

Old and recent picture of di Alaafin of Oyo

Wia dis foto come from, Alaafin of Oyo

Wetin we call dis foto, Oba Lamidi Adeyemi spend 52 years as di Alaafin of Oyo wey make am di longest serving monarch for dat capacity
Di Alaafin of Oyo Oba Adeniran Adeyemi II and di current Oba Lamidi Olayiwola Adeyemi III, Alaafin of Oyo for floor

Wia dis foto come from, Instagram/@alaafin_oyo

Wetin we call dis foto, Dem born Oba Lamidi on October 15, 1938 but e no live for di palace, in fact na for Isinyin near Oyo dem bin raise am.
Oba Lamidi Adeyemi

Wia dis foto come from, @ALAAFINOFOYO

Wetin we call dis foto, Before dem go crown am as Alaafin of Oyo, e bin dey work as insurance clerk and don already marry two wives
Alaafin of Oyo for im coronation

Wia dis foto come from, Alaafin of Oyo

Wetin we call dis foto, Dis na Oba Lamidi Adeyemi III di day im make im first appearance for Koso Sango shrine with Ade Songo (Songo crown for im head)
Alaafin of Oyo for im first appearance as Alaafin

Wia dis foto come from, Alaafin of Oyo

Wetin we call dis foto, Oba Lamidi Adeyemi bin dey 31 years old wen im ascend di throne and e bin get two wives by dat time. Dis foto dem take am on di 14th of January, 1971 wen im coronation happun
Alaafin and im wives

Wia dis foto come from, Facebook/Alaafin Oba Adeyemi III

Wetin we call dis foto, As at im death e bin don marry more wives wey all born for am - E no clear how many be di total
Alaafin and im wives

Wia dis foto come from, Alaafin Oba Adeyemi III

Wetin we call dis foto, Alaafin and im wives
Alaafin of Oyo and some of im wives

Wia dis foto come from, Instagram/@alaafin_oyo

Wetin we call dis foto, Di two im bin get before im get di title as Alaafin of Oyo na Ayaba Abibat Adeyemi and Ayaba Rahmat Adedayo Adeyemi
Alaafin and im pikin dem

Wia dis foto come from, Intagram/@ayabs_folashade

Wetin we call dis foto, Tori be say e get pass 20 pikin dem and im get multile births like dis triplets
Alaafin of Oyo

Wia dis foto come from, Alaafin of Oyo

Wetin we call dis foto, Di Alaafin of Oyo bin dey very active in sports even till im last days
Alaafin of Oyo

Wia dis foto come from, Instagram/@alaafin_oyo

Wetin we call dis foto, Di Alaafin also get honorary doctorate from di University of Maiduguri
Alaafin of Oyo

Wia dis foto come from, Facebook/ Alaafin Oba Adeyemi III

Wetin we call dis foto, Di Alaafin of Oyo bin pick up boxing and continue to dey use am exercise till as early as January dis year.
Alaafin of Oyo

Wia dis foto come from, Facebook/ Alaafin Oba Adeyemi III

Wetin we call dis foto, According to tori pipo, e reach ten pipo wey fit be di next Alaafin