Rotimi Amaechi 2023: Buhari Transport Minister declare to be Nigeria 2023 president

Wia dis foto come from, OZUMONU GUDU
Rotimi Chibuike Amaechi, Nigeria Minister of Transportation, don declare interest to contest 2023 presidential election.
Amaechi declare to contest under di platform of di All Progressives Congress [APC] wey be President Muhammadu Buhari goment party.
E become di first serving cabinet minister for Buhari goment wey don declare to succeed di Nigerian leader on May 29, 2023.
Right Honourable Rotimi Chibuike Amaechi make di declaration on Saturday for di Adokiye Amiesimaka Stadium, Port Harcourt, during di Rivers State APC Thanksgiving service.
Nigerian public dey already tok about Amaechi declaration as a serving minister for social media platforms.

Wia dis foto come from, Ozumonu Gudu
Di former Govnor of Rivers State tok say im go seek di party ticket to succeed President Muhammadu Buhari.
"I stand before you today to declare my intention and submit my application to serve as your next President", Amaechi tok in from di crowd wey gada for di stadium.
Former National Chairman, Adams Oshiomhole, current APC National Vice Chairman South-South Victor Giadom, Senator Ali Ndume, plus odas dey among top APC chiefs wey show face for di ceremony.
End of Di one wey oda users dey read well well
Rotimi Chibuike Amaechi say im no arrive at dis decision to serve lightly.
"23 years of service don equipped me not only with great experience in governance and public service but also compassion for di ordinary citizens of our dear country." Di politician tok during im declaration.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post
Amaechi don join oda politicians like Bola Tinubu, Govnor Yahya Bello, Orji Uzor Kalu and Rochas Okorocha wey don declare to run for president under APC.

Wia dis foto come from, Ozumonu Gudu
Dis declaration by di transportation minister don add up to di build up to Nigeria general election, as political parties search for a candidate to fly dia flag.
APC don zone di presidential ticket to southern Nigeria and Rotimi Chibuike Amaechi from di oil-rich south-south state of Rivers.
Until e declare interest to succeed im oga [President Muhammadu Buhari] on Saturday, Amaechi na di minister wey dey in charge of Nigeria rail ways, Sea ports and water ways mata.
Na for early 1990s di 56 year old politician join active politics.
Rotimi Chibuike Amaechi become key figure in addressing issue of oil thieves in Nigeria during president Goodluck Jonathan goment.
E bin sabi argue publicly with di president dat time between 2014 and 2015.
Who be Rotimi Chibuike Amaechi?

Wia dis foto come from, Getty Images
Rt. Hon. Chibuike Rotimi Amaechi na Nigeria Minister of Transportation and former Governor of Rivers State.
Dem born am for Ubima, Ikwerre Local Goment Area of Rivers State on 27th May, 1965 to late elder Fidelis Amaechi and wife Mrs. Mary Amaechi.
Amaechi start im educational for St. Theresa primary school from 1970 to 1976, where e pass im first school leaving certificate.
Afta dat e proceed to Government Secondary School Okolobiri for 1977, finish dia and get im West African School Certificate for 1982.
Amaechi later attend University of Port Harcourt for 1983, wia e graduate with honours degree in English Studies and Literature for 1987.
Na for University of Port Harcourt e lay di foundation of im political life.
For dia Amaechi participate actively for student union politics, especially for di National Union of Rivers State Students (NURSS) wey e for be President, and di National Association of Nigerian Students (NANS).
Afta Amaechi complete im National Youth Service for 1988, e join di services of Pamo Clinics and Hospital Ltd.
Pamo Clinics belong to former Executive Governor of Rivers State, Sir Dr. Peter Odili.
For dia Amaechi work as Public Relations Officer until 1992 wen e join partisan politics.
E then become di Secretary of di National Republican Convention inside Ikwerre Local Goment Area.

Wia dis foto come from, Dappa S
From 1992 -1994, Amaechi na di Special Assistant to di Deputy Governor of Rivers State during di Govnor Rufus Ada George goment.
E also be member of di Board of Directors of West Africa Glass Industry plus Risonpalm Nigeria Limited.
As e resume political activities for 1996, Amaechi join di Democratic Party of Nigeria (DPN) and become di State Secretary of di Party Caretaker Committee.
E dey for dis position until di political development in Nigeria stop afta di death of General Abacha.
For 1999, General Abdulsalam Abubakar do according to as e promise to hand over power to elected civilian goment and during dat period Amaechi dey di forefront of politics.
Under di platform of Peoples Democratic Party, Amaechi dey elected as State Legislator to represent Ikwere Constituency for Rivers State House of Assembly for 1999.
E also come dey elected to serve as Speaker of di River State House of Assembly From 1999 to 2007
Amaechi later become Rivers State Governor for 2007 to 2015 under PDPticket. E also become Nigeria govnors forum chairman within dat period.
For 2015 Ameach Rotimi Chibuike Amaechi become di Director General of President Muhammadu Buhari Campaign Organization.
E occupy dis position again for 2019 afta Buhari bin appoint Transportation Minister wen e form him cabinet after 2015.
Na late 2015 Nigeria Senate bin confam Rotimi Chibuike Amaechi as Minister of di Federal Republic.
Na dis position e still dey hold until Saturday 9th April, 2022 wen e declare to contest to be Nigeria 2023 president.
But e get two hurdles to pass before di politician fir achieve im ambition.
Di first na to secure di rulingAll Progressives Congress presidential ticket to fit contest di election.
And then di bigger task na to convince Nigerians to vote am as President Buhari successor for di 2023 election.














