Rita Amenze Italy murder: FG speak on Italian husband alleged killing of im Nigerian wife

Rita Amenze Italy murder: FG speak on Italian husband alleged killing of im Nigerian wife

Wia dis foto come from, others

Wetin we call dis foto, Rita Amenze

Nigerian goment don condemn di alledged killing of one of dia citizen Rita Amenze by her Italian husband for Italy.

Di Nigerian in Diaspora commission don call for justice and demand full investigate into di killing of di 31-year-old Nigerian lady.

For inside statement, di commission say di alleged killing of di housewife by her husband na because she file for divorce.

For update on di sad event, Nigerians in Diaspora Commission [NIDCOM] say authority don arrest di estranged husband.

Dem don arrest Oga Pierangelo Pellizzar, di Chairman/CEO, of NIDCOM Hon. Abike Dabiri-Erewa tok.

Similarly, di President of National Union of Nigerian Associations for Italy (NUNAI), Rowland Ndukuba condemn di killing.

Ndukuba thank di Police authorities for di arrest of di husband.

Nigerian Ambassador to Italy Mfawa Omini Abam, also tok say di Embassy go make sure say dem carry out proper investigation.

Rita Amenze Italy murder: FG speak on Italian husband alleged killing of im Nigerian wife

Wia dis foto come from, others

Wetin we call dis foto, Italian Newspaper report arrest of Rita Amenze husband

Wetin we know about di death of Rita Amenze

Tori be say Rita bin file for divorce wey make her ex-husband vex and later kill her.

Di 61-year-old Italian man, Pierangelo Pellizzar, bin allegedly shoot dead im 31-year-old Nigerian wife, Amenze Rita, for Italy.

Dem kill Rita in front of her colleagues for di parking lot of Mf Mushroom, one company wia she bin dey work on Friday morning, for Noventa Vicentina.

From reports, di suspect, Pellizzar bin waylaid im estranged housewife at about 7:30am and shoot her four times, until life was gone out of her.

Rita wey just return from Nigeria one week ago, bin arrive for Italy in 2017 through Libya and got married to di Italian man in 2018.