Stan Nze wedding: Nollywood Stanley Ebuka Nzediegwu, Blessing Jessica Obasi marriage foto

Wia dis foto come from, Other
No be everiday you go see two popular Nollywood actors marry each oda.
Well, e don happun - Nollywood stars Stan Nze and Blessing Jessica Obasi wedding go down on Saturday September 11, for Lagos.
Di couple don dey date for a long while before dem marry.
Family and friends of Stanley and Blessing attend dia wedding.
Singer Timi Dakolo sing for di couple and guests for di wedding reception.
Di two already don do dia marriage introduction last week for Stan Nze wife hometown inside Abia State, south eastern Nigeria.
Stan Nze wedding pictures

Wia dis foto come from, Stan nze

Wia dis foto come from, Kamani Photography

Wia dis foto come from, Kamani Photography

Wia dis foto come from, ScREEN SHOT

Wia dis foto come from, Other

Wia dis foto come from, Stan Nze
Who be Stan Nze?
Stanley Ebuka Nzediegwu na act Ahanna inside di 2020 Nollywood remake of Amaka Igwe classic, Rattlesnake.
Dem born Stan Nze on May 15, 1989 inside Lagos, Nigeria, and him be first of five children.
End of Di one wey oda users dey read well well
Im papa, Sabastine, na businessman, and im mama, Chika, na fashion designer.
Stan study computer science for Nnamdi Azikiwe university, Awka, wia e receive a bachelor's degree.

Wia dis foto come from, STAN NZE
After university, Stan thereafter go training for acting for di Stella Damasus Arts Foundation.
Stan Nze start im acting career in 2009 with a minor role in a television series, Private Sector wey dey followed by guest appearances in some oda TV series.
Stan get im first major role in 2013 - A bipolar serial killer inside di movie, Murder At Prime Suites (MAPS).
Who be Blessing Jessica Obasi?
Blessing Jessica Obasi na popular Nollywood actress from Abia State south Eastern Nigeria.
She also be producer and entrepreneur.
Di film wey she dey proud of wey she produce na Prophetess.
Blessing Jessica Obasi don also play roles for TV soaps for Nigeria.
She school for University of Lagos wia she get Bachelor of Science (BSc) in Industrial relations and personnel management between 2006 and 2010.
Blessing Jessica Obasi dey in her early 30s.

Wia dis foto come from, Blessing Jessica Obasi
For Nigeria, marriage na big deal, even bigger deal if na celebs dey marry.
Dis fit be sake of society values and how celebs dey get cult followership.
As influencers, dis celebs personal life na tin of public interest.
Again, over di years some celebrity couple marriages don crash.
And wen dat kain tin happun e dey sometimes take longer to heal or see anoda celebrity couple to come out publicly to express dia love.














