School resumption in Nigeria update today: University of Lagos, UNIBEN and oda tertiary institutions for Nigeria re-opening dates

Wia dis foto come from, Getty Images
Many Nigerian Universities don begin announce date for resumption.
Dis wan dey come afta Federal Government bin tok say dem go review di January 18 earlier date wey e fix for all schools for di kontri to resume sake of di increase in Covid-19 cases.
University of Jos (UNIJOS), University of Lagos (UNILAG), University of Benin (UNIBEN) don notify students and lecturers of dia resumption.
Universities bin dey under lock and key for nine months sake of coronavirus den ASUU strike sake of goment inability to fulfil dia 2009 agreement.
Di whole yawa bin ground public tertiary education for di kontri and students bin sidon house from March 2020 until ASUU and goment settle dia kwanta on di 23rd of December, 2020.
Even though ASUU call off di strike, student bin no fit resume immediately sake of di directive from di Presidential Taskforce on Covid -19 say make all schools close sake of di second wave of infection.
See di list of some universities and dia resumption dates.
University of Lagos
Di authorities of University of Lagos approve January 25 as di resumption date for lectures inside di institution.
End of Di one wey oda users dey read well well
For di revised Academic calendar for 2019/2020 session wey UNILAG bring for first semester, di school go begin with online lecture on January 25th.
Some public university students across Nigeria go begin get ready and prepare to return to school from di 18th of January, 2021.

Wia dis foto come from, Unilag

Wia dis foto come from, unilag
LASU
Special Adviser to Lagos state goment Tokunbo Wahab tell BBC Pidgin say tertiary school for Lagos already dey in session but dem dey operate staggered resumption.E say di final year students dey allowed to enter school premises and gradually odas go join, say dat na to ensure say students no too plenti for school.
University of Benin (UNIBEN)
Di management of University of Benin, for Edo state don ask both old and new students to resume school from di 30th of January, 2021.
Dis dey inside di circular wey di school issue afta dia Senate meeting on Monday.
Di school say di 2019/2020 academic session first semester go run until April 1, 2021 while di second semester go start for April 5.
Di school tok-tok pesin Benedicta Ehanire say, afta di school Senate meet on di 4th of January, dem agree say if student show for school on di 30th, lecture go start on di 1st of Febraury, 2021.
Meanwhile, fresh students gatz start dia clearance online from 5th of February to 30th of April and dem go begin dia orientation for di 3rd of May, 2021.
University of Port Harcourt
According to di school authorities, returning students go return from 29th - 31st January while lectures go resume by 1st of February.

Wia dis foto come from, UNIPORT
Meanwhile, Rivers state university don resume since 4th January 2021 afta di Christmas break.
University of Ilorin
University of Ilorin begin online lectures on Monday, 11th January, as dem bin schedule am.
Management say all necessary arrangements dey ground to ensure correct online classes pending di time wen e go safe to conduct normal physical lectures.
University of Jos
After more than nine months of closure, University of Jos go reopen January 22 2021 to continue dia academic activities for di 2019/2020 session.
Di University tok say di na di Senate of di institution approve di reopening of di school durig dia 4th special meeting wey dem do on Monday, January 11, 2021.
Bayero University Kano (BUK)
Di Senate for Bayero University Kano go begin new academic session for January 18, 2021 and dia second semester go be May 3, 2021.
Di university issue out memo say dem don cancel dia 2019/2020 sessions for all undergraduate and postgraduate programmes for di school.
Di senate also grant amnesty for postgraduate students wey neva register within di time wey dem give dem, make dem kontinu wit dia registration before di session start.
University of Abuja
University of Abuja set January 4, 2021 to January 29, 2021 as date di Academic Staff chook eye inside virtual classroom teaching.
We still dey update dis tori.














