School resumption 2021: Schools go reopen for Kogi, Rivers, Bayelsa in January

Wia dis foto come from, Other
Public and private schools for Rivers State go reopen for normal academic activities on Monday 4 January, 2021.
Dis na according to statement form di State Ministry of Education wey di Permanent Secretary, Sir Chidi Adiele sign.
E different from di 18 January 2021 date wey Federal Goment bin give for schools to reopen across di kontri Assembly dey plan and prepare against di second wave of di Covid-19 pandemic.
Di Statement say wit di approval of Governor Nyesom Wike, dem dey stick to di school calendar dem bin publish for August 2020, come ask all schools to maintain all Covid-19 protocols, including wearing of facemask, use of hand sanitizers and staggered classes of morning and afternoon session to avoid overcrowding as dem dey resume.
Bayelsa schools go reopen on January 11
Meanwhile, all primary and secondary Schools for Bayelsa State go reopen on Monday 11 January, 2020.
According to Statement from di Commissioner for Education, Gentle Emelah, boarding students go resume on Sunday 10 January, 2021 and schools must strictly obey all COVID-19 protocols.
Schools for Kogi go reopen on January 18
Kogi State Government don announce say all schools for di state go start dia first term academic session from Monday, January 18.Di Commissioner for Education, Science and Technology, Wemi Jones wey make di announcement say di state goment, Yahaya Bello don beat im chest to make education for di state di best and sake of dat, say di state
no fit afford to close school afta January 18.
End of Di one wey oda users dey read well well
Oga Jones say di educational sector for di state neva recover from di first lockdown for di kontri despite say di state bin dey covid free.
E say despite di second wave of coronavirus for Nigeria, di state no fit jeopardise education for di state and n aim make di goment decide to reopen school.
Di Commissioner say make all stakeholders for education sector for di state begin prepare to ensure say dem follow goment directive to open school.











