You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
Nigeria President Buhari order immediate reopening of land borders
Nigeria President Muhammadu Buhari don order di immediate reopening of four of di kontri land borders.
Minister of Finance, Zainab Ahmed wey make di announcement on Wednesday say di President don give green light for di reopening of Seme, Illela, Maigatari and Mfun borders.
Nigeria goment bin close dia land borders for August 2019 to stop di importation of weapons, agricultural products and drugs into di kontri from neighbouring countries.
Di closure of di border bin cause plenti gbege between Nigeria and oda neighbouring kontris as dem cry say di goment policy dey affect dia economy.
Leaders of dis kontris bin engage di Nigerian goment to change di policy but di goment bin no gree before but for December 8, 2020, president Buhari yarn give say im plan to reopen di land borders dem.
Before now, di goment bin don reveal plans to reopen dia borders.
President Buhari bin tok dis one wen e hold security meeting wit members of di Nigeria Governors' Forum (NGF) for di Presidential Villa, Abuja.
E say now wey all di Neighbour's don learn dia lesson, di goment don ready kampe to open di border again.
End of Di one wey oda users dey read well well
President Buhari also direct make other land borders reopen by December 21, 2020.