Omah Lay and Tems released: Nigerian musicians Omah Didia and Temilade Openiyi arrive Lagos airport

Read am in 2 mins

Nigeria goment don confam say musicians Omah Lay and Tems wey Uganda charge wit offence don return back to di kontri.

Madam Abike Dabiri-Erewa, di oga of goment agency Nigerians in Diaspora Commission (NIDCOM) na im announce dis one for Twitter.

Abike bin tell BBC on Tuesday say Uganda don drop offence charge - one day afta di two musicians face one Magistrate court.

Uganda Police bin don charge Stanley Omah Didia alias Omah Lay, Temilade Openiyi alias Tems, plus one oda Nigerian Muyiwa Awoniyi wit offence of "negligently doing acts wey fit spread infectious diseases".

Ugandan artiste Bebe Cool enter Twitter to show court papers wey order di release of di three Nigerians.

Di document also torchlight say na one Kigo Prison dem bin keep dem put.

Presidential candidate Bobi Wine, wey dey contest again president Yoweri Museveni for Uganda general elections, say im own lawyers join inside di fight to drop all charge for di Nigerians and say e sweet im belle say e happen.

Reactions from Nigerians

Many Nigerians, including politicians, bin don call for dia goment to sharpaly follow Uganda relate to make sure say di Omah Lay and odas no tey for jail.

And so when tori of dia release comot, many of dem social media to thank all those wey chook mouth for di mata, and di Nigerian goment for how dem no slack.