Fifa Fifpro World 11: See all 55 players wey make di list of most voted for 2020 edition

Salah, Mane and Aubameyang

Wia dis foto come from, Getty Images

Sadio Mane of Senegal, Mohamed Salah of Egypt follow for di list of 55 players wey collect di most votes for di 2020 edition of Fifa Fifpro World 11.

Di award of World 11 (or World XI), wey bi annual selection of di best eleven players, na di only official team wey na professional players dey nominate am.

Pierre-Emerick Aubameyang of Gabon and Kalidou Koulibaly of Senegal, complete di four African players wey make di list.

For professional players to qualify, dia kontri football association must be members of di FIFPro wey be di joinbodi wey dey represent 65,000 professional football players worldwide.

Nigeria for instance, no bi member.

Every footballer under Fifpro go each nominate 11 players - 1 goalkeeper, 3 defenders, 3 midfielders and 4 forwards. Di oda awards wey players go nominate for na di e FIFA Ballon d'Or, wey dey go to di overall best player.

All 55 players for di Fifpro shortlist

Wia dis foto come from, Fifpro

Heung-Min Son na di only Asian player make di shortlist and Cristiano Ronaldo na di only player wey don dey di shortlist every year since dem start di awards for 2005.

See di full list of 55 players

Goalkeepers

  • Alisson Becker (Liverpool FC, Brazil)
  • Thibaut Courtois (Real Madrid, Belgium)
  • David De Gea (Manchester United, Spain)
  • Gianluigi Donnarumma (AC Milan, Italy)
  • Moraes Ederson (Manchester City, Brazil)
  • Hugo Lloris (Tottenham Hotspur, France)
  • Keylor Navas (Paris Saint-Germain, Costa Rica)
  • Manuel Neuer (FC Bayern Munich, Germany)
  • Jan Oblak (Atletico Madrid, Slovenia)
  • Marc-Andre ter Stegen (FC Barcelona, Germany)

Defenders

  • David Alaba (FC Bayern Munich, Austria)
  • Jordi Alba (FC Barcelona, Spain)
  • Toby Alderweireld (Tottenham Hotspur, Belgium)
  • Trent Alexander-Arnold (Liverpool FC, England)
  • Dani Alves (Sao Paulo, Brazil)
  • Jerome Boateng (FC Bayern Munich, Germany)
  • Alphonso Davies (FC Bayern Munich, Canada)
  • Virgil van Dijk (Liverpool FC, The Netherlands)
  • Kalidou Koulibaly (SSC Napoli, Senegal)
  • Matthijs de Ligt (Juventus FC, The Netherlands)
  • Marcelo (Real Madrid, Brazil)
  • Sergio Ramos (Real Madrid, Spain)
  • Andrew Robertson (Liverpool FC, Scotland)
  • Thiago Silva (Chelsea, Brazil)
  • Raphael Varane (Real Madrid, France)

Midfielders

  • Thiago Alcantara (FC Bayern Munich, now Liverpool), Spain)
  • Dele Alli (Tottenham Hotspur, England)
  • Sergio Busquets (FC Barcelona, Spain)
  • Casemiro (Real Madrid, Brazil)
  • Philippe Coutinho (FC Bayern Munich, now FC Barcelona, Brazil)
  • Kevin De Bruyne (Manchester City, Belgium)
  • Bruno Fernandes (Manchester United, Portugal)
  • Leon Goretzka (FC Bayern Munich, Germany)
  • Jordan Henderson (Liverpool FC, England)
  • Frenkie de Jong (FC Barcelona, The Netherlands)
  • N'Golo Kante (Chelsea FC, France)
  • Toni Kroos (Real Madrid, Germany)
  • Joshua Kimmich (FC Bayern Munich, Germany)
  • Luka Modric (Real Madrid, Croatia)
  • Thomas Muller (FC Bayern Munich, Germany)

Forwards

  • Sergio Aguero (Manchester City, Argentina)
  • Pierre-Emerick Aubameyang (Arsenal, Gabon)
  • Karim Benzema (Real Madrid, France)
  • Serge Gnabry (FC Bayern Munich, Germany)
  • Erling Haaland (Borussia Dortmund, Norway)
  • Zlatan Ibrahimovic (AC Milan, Sweden)
  • Harry Kane (Tottenham Hotspur, England)
  • Robert Lewandowski (FC Bayern Munich, Poland)
  • Sadio Mane (Liverpool FC, Senegal)
  • Kylian Mbappe (Paris Saint-Germain, France)
  • Lionel Messi (FC Barcelona, Argentina)
  • Neymar Junior (Paris Saint-Germain, Brazil)
  • Cristiano Ronaldo (Juventus, Portugal)
  • Mohamed Salah (Liverpool FC, Egypt)
  • Heung-Min Son (Tottenham Hotspur, South-Korea)