UEFA Champions League fixtures: Wetin Real Madrid, Man Utd need to progress, plus how to watch di games

Wia dis foto come from, Getty Images
Nine teams don already qualify for di round of 16 of Uefa Champions League and seven more go join dem on Tuesday and Wednesday afta match day five.
Real Madrid, Manchester United, Atletico Madrid, Inter Milan and Ajax na some of di 'big teams' wey leg dey shake for di competition, see wetin dem need to qualify.
See Teams wey still fit reach di round of 16
Group A: Atlético, Salzburg
Group B: Borussia Mönchengladbach, Shakhtar Donetsk, Real Madrid, Inter Milan
Group D: Atalanta, Ajax
Group F: Lazio, Club Brugge
Group H: Manchester United, Paris Saint-Germain, Leipzig
Teams wey don qualify for round of 16
Group A: Bayern München
End of Di one wey oda users dey read well well
Group C: Manchester City, Porto
Group D: Liverpool
Group E: Chelsea, Sevilla
Group F: Borussia Dortmund
Group G: Barcelona, Juventus
Group H: Paris Saint-Germain vs İstanbul Başakşehir, Leipzig vs Manchester United

Wia dis foto come from, Getty Images
Manchester United go qualify if dem avoid defeat to Leipzig. United go finish first if dem avoid defeat and PSG no beat Başakşehir.
PSG go qualify if dem avoid to Başakşehir, or even if dem lose and di oda game no end for draw. PSG go finish first if dem win.
Leipzig go qualify if dem beat United, or if dem draw and PSG lose to Başakşehir. Leipzig go finish first if dem win and PSG lose.
İstanbul Başakşehir already dey sure of finishing fourth.
Group A: Bayern vs Lokomotiv Moskva, Salzburg vs Atlético Madrid
Bayern don qualify for di round of 16 as group winners.
Atlético go qualify if dem avoid defeat to Salzburg. If dem lose, go enta UEFA Europa League round of 32 in third place.
Salzburg go qualify through if dem beat Atlético. Dem go finish third if dem no win, provided say Lokomotiv no beat Bayern.
Group B: Real Madrid vs Borussia Mönchengladbach, Inter vs Shakhtar

Wia dis foto come from, Getty Images
Borussia Mönchengladbach go qualify if dem avoid defeat or if Shakhtar draw with Inter. Mönchengladbach go finish first if dem win.
Borussia Mönchengladbach no fit finish below third place.
Shakhtar go qualify if dem beat Inter, or if both games end for draw. Shakhtar go win di group if dem win and Mönchengladbach no win.
Shakhtar go finish fourth if dem lose and Madrid avoid defeat.
Real Madrid go qualify if dem beat Mönchengladbach, or if dem draw and Shakhtar lose to Inter. Madrid go win di group if dem win and Shakhtar no win.
Madrid go finish fourth if both they and Shakhtar lose.
Inter go qualify if dem beat Shakhtar and di oda game no end for draw. Inter go finish fourth if dem no win.
Group D: Ajax vs Atalanta, Midtjylland vs Liverpool
Liverpool don qualify as group winners.
Atalanta go qualify if dem avoid defeat to Ajax.
Ajax go qualify if dem beat Atalanta.
Midtjylland go finish fourth.
Champions League fixtures
Tuesday
Lazio v Club Brugge
Zenit v Dortmund
Barcelona v Juventus
Chelsea v Krasnodar
Dynamo Kyiv v Ferencvaros
PSG v Istanbul Basaksehir
RB Leipzig v Man Utd
Rennes v Sevilla
Wednesday
Ajax v Atalanta
FC Midtjyll v Liverpool
Bayern v Lokomotiv Moscow
Inter v Shakhtar
Man City v Marseille
Olympiacos v Porto
Real Madrid v M'gladbach
Red Bull Salzburg v Atlético
How to watch Tuesday Champions League fixtures
All Tuesday and Wednesday matches dey live for Nigeria for cable channel SuperSport wey be Uefa broadcast partner for sub-sahara Africa.













