Champions League results: Liverpool qualify for last 16, Real Madrid and Inter Milan get to wait

Wia dis foto come from, Getty Images
Liverpool don book dia place for di next round of di Uefa Champions League after dem beat Ajax 1-0 for Anfield on Tuesday.
Teenager Curtis Jones na im score di only goal of di game to help di 2019 Champions League winners to progress to di last 16.
But fans of Atletico Madrid, Real Madrid and Inter Milan go dey bite dia nails as dis clubs stilll never know dia status after five matchdays.
Atleti draw 1-1 at home to Bayern Munich, Real Madrid lose away to Shakhtar Donetsk while even though Inter Milan beat Borussia Mochengladbach 3-2 dem still dey bottom of dia group wit only five points
Bayern and Manchester City don already dey through to round of 16.
Champions League results (Tuesday)
Group A
Lokomotiv Moskva 1-3 Salzburg
Atlético 1-1 Bayern
End of Di one wey oda users dey read well well
Group B
Shakhtar Donetsk 2-0 Real Madrid
Mönchengladbach 2-3 Internazionale (21:00)
Group C
Marseille 2-1 Olympiacos
Porto 0-0 Man. City
Group D
Liverpool 1-0 Ajax
Atalanta 1-1 Midtjylland












