Champions league result: PSG vs Istanbul Başakşehir match chop suspension afta Pierre Webo allegation of racism

Champions League

Wia dis foto come from, Reuters

Read am in 1 mins

Di match between Paris Saint Germain and Istanbul Basaksehir suffer suspension afta one of di match officials face accuse of allegedly using racist term against one of di away team coaching staff.

Cameroonian Achille Webo, assistant coach of Turkish club Istanbul Basaksehir, say e allegedly suffer racist insults by 4th referee.

Report say de fourth referee allegedly call assistant coach, "Negro" weh e mean black man.

Webo say deh sack e from field before, Sébastien Coltesu, Romanian, referee, call'am 'Negro'.

All de players and coaches leave di stadium afta playing only 10 minutes of di match.

Champions League

Wia dis foto come from, Reuters

Uefa say di match go resume on Wednesday by 7pm.

Cameroon roving ambassador, legendary player don send encouraging words for e broda, Achille Webo.

Skip X post
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of X post

Turkish president don condemn suspicion for racist tok for PSG - Turkish side match.

Cameroonians don take dia vex for Facebook as deh say no to racism.