Buhari speech on End SARS protest and wetin go happun next

End SARS protester hold placard

Wia dis foto come from, Getty Images

Read am in 3 mins

Nigeria President Muhammadu Buhari finally do wetin many pipo don dey ask for since di End SARS protest for streets begin for over two weeks on Thursday 23, October 2020.

Dat na to address di nation.

For di recorded broadcast ontop di kontri National Television Authority (NTA) wey last for about ten minutes, di president acknowledge di fact say soem pipo take advantage of di protest wey youths begin to legit demand for an end to police brutality and also end to di police Special Anti-Robbery Squad (SARS) to cause violence and katakata for di kontri.

Di president ask di youth to stop street protests and constructively engage goment to find solutions.

Di president speech no tok about di curfew wey some states don already impose to try to stop di violence and destruction wey hoodlums and thugs don dey carry out .

Di president no also tok about di shootings wey happun for di Lekki toll gate wey injure ova 30 pipo and kill at least one pesin.

So di question wetin go happun next be wetin some pipo dey ask now.

Nigeria SARS protest

End to protests?

President Buhari say for im speech: "I call on our youth to stop street protest and constructively engage goment to find solutions."

But dem go stop?

One of di things wey stand dis protest out na di young pipo wey insist say dem no get leader, so at dis time many dey wonder if anybody go fit stop dem from coming out.

But some of di pipo wey carry di mata well-well wey some of di youths look up to don dey tell youths to stay off di street.

Ogbonge musician wey be part of di End SARS protests tweet say: "Wetin we don start sweet me for belle, I dey proud to be part of such important moment, We don wake up finally."

End SARS protester hold placard

Wia dis foto come from, AFP

Feminist Coalition wey be one of di organisations pipo sabi well-well wey carry di mata of di protest for head and wey raise about N147,855,788 for di protest don release statement say make young pipo march break obey curfews wey dey dia states and stay home and safe for now.

Skip X post, 1
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of X post, 1

End to violence?

President Buhari say di goment go respect and go continue to respect all di democratic rights and civil liberties of di pipo, but di goment no go allow anybody or groups to disturb alias disrupt di peace of di nation.

Wetin e mean?

E no clear but wetin we know be say Nigeria President on Thursday give direct order to security agencies to use any means wey dey for law book to stop di katakata wey dey happun across di kontri.

Buhari also order law enforcement agents to bring back law and order back for places wey dey experience chaos for di kontri.

Protester carry placard

Wia dis foto come from, Getty Images

What about di End SARS protesters 5for5 demands?

Di End SARS protesters bin make some demands for goment to meet wey include di immediate release of protesters wey dem arrest, justice for victims of police brutality and compensation for victims plus welfare of police officers.

Federal goment say dem accept am, President Buhari repeat am for im nationwide broadcast and states for di kontri don begin set up panels to chook eye for cases of police brutality.

How pipo react to Buhari speech

Di reaction to President Buhari speech na well-plenti.

See some of dem from social:

Skip X post, 2
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of X post, 2

Skip X post, 3
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of X post, 3