Warri prison break: Hoodlums attack Warri Prison for Okere road, set fire

Wia dis foto come from, Screenshot
Some jaguda pipo alias hoodlums try to break into Warri Prison wey dey Okere road for Delta State, southern Nigeria.
Di prison attack for Warri Correctional Centre happun on Thursday 22 October, 2020 about di same time Ikoyi prison attack bin happun.
Police confam give BBC Pidgin say jaguda pipo attempt jail break for di prison inside Warri South Local Government Area of Delta State, Nigeria.
"Since di Benin prison break happun, police for Delta state don dey guide di Okere prison to make sure say such tin no happpun for dia." Di tok-tok pesin for police inside Delta State Onome Onovwakpoyeya tok.
E no dey clear weda some prisoners escape but some videos for social media wey capture wetin happun show di door of di prison open at some point.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post
Di police PRO tok say dem get report say di inmate na dem set fire inside di prison but outside side of di prison don dey calm because police tanda dia.
Tori be say di hoodlums wey dey claim to protest move from Effurun roundabout dey shout "Okere prison, Okere Prison" and begin move towards di prison but policemen don dey already on ground to repel any attack.
For now, she no know if any inmate escape from di prison but she dey wait for di prison warders to informate dem if any escape haapun or not, Di police PRO add.
End of Di one wey oda users dey read well well

Wia dis foto come from, GbaramatuVoice

Wia dis foto come from, GbaramatuVoice
Meanwhile di Public Relations Officer of Delta state Command of Nigeria Correctional Service, Uche Mgbakor tell BBC Pidgin say she no think say any prisoners escape but dem still dey take head counts of di number of pipo wey dey di prison.
She add say na only one pesin injure for di attack wey haapun as di protesters bin try to get inside di prison but everything don dey under control.

Wia dis foto come from, GbaramatuVoice

Wia dis foto come from, GbaramatuVoice
Earlier before dis attack di Delta State govnor Ifeanyi Okowa decare 48 hours curfew for di state afta jaguda pipo go attack goment buildings.
Di prison attack for Warri Correctional Centre happun today around di same time Ikoyi prison and Okitipupa prison attack bin happun.
Na 58 prisoners escape from Okitipupa Prison break wey happun today for Ondo State south west Nigeria.
But authorities tell BBC say everitin don dey under control for di prison.
Meanwhile President Buhari don direct security agencies to use any lawful means to stop di violence across di kontri afta jaguda pipo hijact di EndSARS protest to end police brutality.
Details later.
















