Edo State Prison Break: Federal Government explain 19 October Benin Prison break as Godwin Obaseki declare curfew

Wia dis foto come from, ScREENSHOT
Federal Government don explain how 19 October Benin Prison break happen for Edo State.
Some pipo wey dem suspect to be End SARS protesters attack di prisons alias Custodial Centres for Benin and Oko inside Benin City on Monday morning and free inmates wey dey dia.
Nigerian Correctional Service (NCoS) explain for statement wey tok wetin happen wey lead to di escape of some inmates for di southern Nigeria state.
"Dis tin wey haapen dey bad as e no show di peaceful, no violence, no destruction style wey #EndSARS protesters dey always preach about". NCoS Public Relations Officer, DCC AC Njoku add.
"Di exact figures of inmates wey escape and pipo wey die alias casualties no dey confirm yet and we go tok how many afta first hand alias preliminary investigations."
Di Nigerian Correctional Service add say efforts don dey go on to arrest di situation and return everi-everi back to normal for di Centres.
And di Armed Squad Personnel of di Service dey work tirelessly to bring di situation under control, dem add.
Di prison service also advise pipo for public to go about dia business for peaceful manner, resist and no gree make anybody use dem to destabilize di peace inside Edo State.
End of Di one wey oda users dey read well well












