Curfew for EndSARS protests: Nigerian States wey don declare curfew for #EndSARS protests

Some states Governors for Nigeria don declare alias impose curfew wey mean no movement inside states wia #EndSARS protests don cause kasala.
Di reason why state governors impose curfew say na because jaduga pipo alias hoodlums don hijack di [EndSARS] protest to begin cause confusion for dia states.
See Nigerian states wey impose curfew for #EndSARS protest

Wia dis foto come from, Other
Lagos state
On Tuesday 20 October, 2020, Lagos State Govnor, Babajide Sanwo-Olu impose 24 hour curfew for all parts of Lagos starting from 4pm.
But e later come extend di curfew time to start by 9pm for pipo to fit reach dia houses sake of heavy traffic.
Di govnor say na because say jaduga pipo don hijack di peaceful End SARS protest to do evil across Lagos.
Oga Sanwo-Olu say na only essential workers and first responders go fit waka for road.

Delta state
Governor Ifeanyi Okowa declare 48 hours curfew for di state on Thursday 22, October, 2020.
For inside State broadcast, e say make evribodi for di state go sidon for house and after di 48 hours, dem go review di situation to see di next step to take.
End of Di one wey oda users dey read well well
Di Governor also close down all public and private schools till Monday 2 November, 2020.
Governor Okowa say dis measure dey necessary becos jaguda boys don hijack di End Sars protests wey youths dey do wey evribodi commend and dem destroy and burn some goment buildings for Asaba on Wednesday 21 October, 2020 during di protests.

Wia dis foto come from, Willie Obiano
Govnor Willie Obiano of Anambra State impose 24 hour curfew for di south east Nigeria state from 8pm on Thursday 22 October, 2020.
Obiano for broadcast e give earlier in di day tok say based on say prevention dey better cure alias precautionary steps to prevent further descent to lawlessness.
Di govnor say di curfew go dey until dem bring di rising tension under control.
Therefore, all schools and markets in Anambra State go dey closed. All gatherings by groups and associations under any name or label from 8pm dey banned. Di govnor tok.
Govnor Willie Obiano say di law enforcement agencies in the state have been duly directed to enforce compliance.

Wia dis foto come from, Rivers State Government House
Rivers State
Governor Nyesom Wike on Wednesday put 24 hour curfew for parts of Rivers State.
Na sake of violence wey happen for parts of Port Harcourt and one oda town for Rivers State in di name of #EndSARS protests, Governor Wike announce for broadcast.
Di curfew go start by 6:30pm on Tuesday 21 October, 2020.
Tori be say For Port Harcourt di Ikoku Spare parts market na no go area as jaguda pipo begin clash wit police in di name of EndSARS protests.
Dem even burn down police station and oda goment facilities for Oyibo Local Goment Area wey dey share common boundary with Abia State
Violence happun for Oil mill area and parts of Mile One and Mile Two for Port Harcourt City, Rivers State
Wike say di State Security council decide to put di 24 hour curfew for Emenike, Ikoku, Iloabuchi axis of Mile 1 and Mile 2 area of Port Harcourt local goment, di whole of Oyigbo local goment area, and Oil mill area of Obio Akpor LGA.
Di Governor direct security agencies to enforce di curfew from 6:30pm for di areas concerned and direct di local goment council chairmen dem to mobilise local vigilante to work wit security agencies to make sure say no jaguda boys disturb di peace or destroy live and property for dia areas.
Im say make Rivers pipo dey alert as dem dey go about dia normal business and report any kurukere movement to security pipo dem.
Osun State
Governor Adegboyega Oyetola impose 24-hour curfew for Osun State on Tuesday.
Di goment of State of Osun put statement wey tok say dem don observe wetin dem call di unfortunate dangerous dimension wey di #EndSARS protests don take across di kontri, particularly for south west States of Nigeria.
Governor Oyetola based on di mata, declare 24-hour curfew on all parts of Osun State from 11.59 pm, Tuesday, 20 October, until further notice.
Di Osun goment say di events of di last 48 hours don show clearly say di protests don dey hijack by criminals and hoodlums.

Wia dis foto come from, Oyetola
Abia state
Abia state Governor Okezie Ikpeazu also put 24-hour curfew for Aba and Umuahia from 6pm on Tuesday, 20 October, 2020 till further notice.
Di Govnor say dis na to make sure say di life and property of pipo inside di state dey safe.
According to di statement from Commissioner for Information, Abia State, John Okiyi Kalu, some hoodlums wey dem count pass 30 attack police officers on official duty around Azikiwe Road.
Dem kill one of di officers and also cari dia arms and ammunition but dem arrest one of di suspected attackers with gunshot injuries.

Wia dis foto come from, ScREENSHOT
Edo State
On Monday 19 October 2020 Edo state goment declare 24-hour curfew for di state till further notice.
Di curfew take effect from 4:00pm dat day.
Di govnor say di decision become necessary inside wetin im call di face of disturbing incidents of vandalism and attacks on private individuals and institutions by jaguda pipo wey disguise as EndSARS protesters.
Dis one dey happun afta some 'hoodlums 'hijack di End Sars protest and begin cause serious tension for di state sotey dem go prison free some inmates.

Plateau state
Plateau state Governor, Simon Lalong impose 24-hour curfew inside Jos South and Jos North Local Government Areas with effect from 8:00 pm today Tuesday, October 20, 2020 till further notice.
Di goment tok for statement say for di past few days, di #EndSARS protests wey begin peacefully don gradually enta bad situation wia hoodlums dey attack and molest innocent citizens wey dey go about dia normal businesses.
Dis development enta anoda level on Tuesday wen protests lead to di destruction of properties, cars and looting of business premises along di Ahmadu Bello way plus di burning of one place of worship along Gyero Road inside Bukuru.
In addition, three deaths na im dem don record.

Wia dis foto come from, Ondo SARS
Ondo State
Gov. Akeredolu impose 24 hours curfew in Ondo
Di way di violent trend of #EndSARS protests dey happun from neighbouring states in di Southwest, di Ondo State Govnor, Oluwarotimi Akeredolu, don direct 24 hours curfew inside di state till further notice.
Di curfew start by 12 midnight Tuesday breaking Wednesday.
Governor Akeredolu say certain elements don hijack di agitation wey originally bin mean to correct di plenti wrongs wey di operatives of di dissolve SARS chop accuse for.
Ekiti State

Wia dis foto come from, KFayemi
EndSARS protests wey jaguda pipo don hijack don make Governor Kayode Fayemi order 24 hour curfew for Ekiti State.
Di 24-hour curfew go affect all parts of di state fro south west Nigeria starting from 10.00 pm Tuesday 20 October, 2020.
Di goment of Ekiti State don observe wit growing concern how di #EndSARS protest, wey bin start as a peaceful protest against police brutality by youths inside Ekiti State, don dey hijacked by some hoodlums, according to statement dem release on Tuesday evening.

Wia dis foto come from, Imo State Government
Imo State
Governor of Imo State, Hope Uzodimma say im don watch wetin im no like as attempt by by some angry pipo try to hijack wetin dey otherwise peaceful protest by di youths to unleash mayhem for di state.
Based on di mata, to ensure say di peace for Imo State (south eastern Nigeria) no dey disturbed, a 24 hour curfew na im di Govnor impose for state till further notice.
Dis one mean say no movement for di state either in di daytime or at night, except for those on approved essential services.
Di curfew na wit immediate from 12 midnight Tuesday 20 October, 2020.
Everione dey aware of di demands of di youths in different parts of di kontri; mainly for di scrapping of di special police unit known as SARS because of di alleged brutal tactics wey dem dey use deal wit members of di public. Govnor Uzodimma add.
Di govnor also ask for di reform of di police force and better conditions of service.

Wetin dey happun for oda parts of Nigeria?
Tori be say anti-riot police unit of di Nigerian Police Force don collect marching order to immediately enta streets sake of violence for di #EndSARS protests.
Dis order wey land Tuesday afternoon from di kontri Inspector General of Police follow how di #Endsars peaceful protest wey youth for di kontri dey do to end police brutality from early October 2020 across Nigeria begin turn violent since dis week.













