Delta state curfew time: Ifeanyi Okowa declare 48 hours movement restriction

Delta State Governor Ifeanyi Okowa

Wia dis foto come from, @GovIfeanyiOkowa

Governor Ifeanyi Okowa don declare 48 hours curfew for di state from 6:00pm on Thursday.

For inside State broadcast, e say make evribodi for di state go sidon for house and after di 48 hours, dem go review di situation to see di next step to take.

Di Governor also close down all public and private schools till Monday 2 November, 2020.

Governor Okowa say dis measure dey necessary becos jaguda boys don hijack di End Sars protests wey youths dey do wey evribodi commend and dem destroy and burn some goment buildings for Asaba on Wednesday 21 October, 2020 during di protests.

Okowa say dia intelligence report show say di pipo wey destroy tins come from oda states and dem no go dey see tins dey spoil.

Di Delta Governor call on di youths to dem give goment chance to respond to di demands as dem don set up judicial panel of inquiry to chook eye to police abuses especially di disbanded SARS for Delta State and also don set up victims support fund to give justice to dem.

Im also ask dem to give room for dialogue so goment fit address di recommendations dem don give.

Di peaceful End SARS protest wey bin dey happun for Nigeria financial capital Lagos turn bloody on Tuesday night afta eyewitnesses say sojas fire live bullets enta protesters begin shoot.

Tins begin get k-leg for di peaceful well organised protest wen some jaguda pipo hijack di protests on Monday begin harass innocent civilians, attack police for Lagos and oda states.