Lagos state goment don relax curfew

Youths for Nigeria protest police brutality and di activities of di Special Anti-Robbery Squad (SARS).

Live Coverage

  1. Visa free kontris wey Nigerians fit travel to

  2. Sanwo-Olu don comot curfew from Lagos with immediate effect

  3. If anybody touch you defend yourself - Inspector General of Police

  4. Lagos State goment don relax curfew time

    Lagos state goment don announce di relaxation of curfew wey dem put afta hoodlums hijack di peaceful 9 protest to take cause kasala for di state.

    Di curfew according to statement from di Commissioner for Information and Strategy, Gbenga Omotoso go now be from 10pm to 6am.

    Di state govnor Babajide Sanwo-Olu hail Lagosians say dem obey di curfew wey dem expect to restore normalcy for di state.

    He beg pipo to go about dia business in peace and no allow anything wey fit disturb di unity wey dey di state.

    Oga Sawo-olu advise pipo wey dey always carry fake tori to stop dey cause hatred among Lagosians, wey pipo sabi say like themselves and dem dey friendly.

  5. Lekki toll gate shooting: Lagos panel pay surprise visit to 'inspect' military hospital mortuary

  6. Lagos State SARS panel discover four bullets and shell casing for di scene of di incident

    Lagos State Judicial Panel on Restitution for Victims of SARS Related Abuses and other Matters

    Wia dis foto come from, BABAJIDE SANWO-OLU/TWITTER

    Wetin we call dis foto, Lagos State Judicial Panel on Restitution for Victims of SARS Related Abuses and other Matters

    Lagos State Judicial Panel on Restitution for Victims of SARS Related Abuses and other Matters don discover four bullets and shell casing for Lekki toll gate.

    Amnesty International bin say di Nigerian Army and di Nigerian Police open fire on peaceful protestors wey kill and injure some of dem for di area and di panel say di visitation na part of dia investigation.

    Police and di army don deny di Amnesty accuse.

    Oga of di Lekki Concession Centre Abayomi Omomuwasan take di panel round di gate where one of di youth representatives, Rinu pick two of di bullet shells dem find.

    Oga Abayomi tell di panel how fire burn dia properties including vehicles and dia control equipment.

    Di Lekki Concession Centre oga tok say on top di plenty rumour say dem comot dia camera, di CCTV camera still dey di position dem keep am.

    He say dem get di footage of how things take happen that day from di CCTV cameras but dem no go release am yet because dem need lawyer.

  7. Who be Mojisola Alli-Macaulay? wey say "Nigerian youths dey high on drugs all di time"

  8. DJ Switch say 'dem dey threaten my life'

    DJ Switch

    Wia dis foto come from, Instagram/@DJSwitch_

    One Nigerian entertainer Obianuju Catherine Udeh AKA DJ Switch, wey live stream wetin happun for Lekki toll gate afta soldier near di place begin shoot don say she receive plenty threats to her life.

    Di popular DJ tok dis one for di interview wey she give one American tori pipo.

    She tok say fear dey hold her sake of di threats wey she dey receive.

    “Dem dey threaten me. I dey fear. I no fit lie about am. Fear dey catch me,” na so she tok for di interview.

    DJ Switch reveal for Instagram say she see at least 15 pipo wey die during di Lekki toll gate attack on peaceful protesters on Tuesday, October 20.

    She add for di interview say her friends wey dey security dey warn her say make she no too dey waka street as dem don mark her face.

    Different report don dey comot ontop wetin happun for Lekki toll gate on dat day. Amnesty International say na 12 pipo die but Lagos state goment say na only two pipo die.

    BBC Pidgin dey di area wey soldiers bin come around 6:45pm on Tuesday and begin dey shoot for air as protesters dey sing dia protest songs.

    DI goment also don set up panel to torchlight wetin happun for Lekki and oda human rights abuses of di Special Anti-Robbery Squad (SARS).

  9. Wetin Desmond Elliot tok wey make some Nigerian youths vex?

  10. Hunger no be excuse to loot – Femi Adesina

    Femi Adesina na Presidnt Muhammadu Buhari tok tok pesin

    Wia dis foto come from, Femi Adesina/Facebook

    Di Special Adviser to President Muhammadu Buhari on media and publicity, Femi Adesina, don yan im own on top di recent looting wey dey happun for different parts of Nigeria.

    Oga Adesina say, no be poverty or hunger, but greed make pipo dey loot Covid-19 palliatives wey some state goments keep for dia warehouses.

    Di presidential tok-tok pesin wey speak to local tori pipo Channels TV say, “na greed and criminality” make pipo go dey loot wetin no belong to dem afta di End SARS protest.

    Im say im no agree at all at all say di kain katakata wey follow di End SARS protest show di true condition of pipo hunger and anger.

    E say: “Just as you no go fit to justify armed robbery becos pesin dey poor and so dia for im cari gun go rob anoda pesin, you no go also fit justify di looting wey dey happun. Na pure criminality.” Im tok.

    Adesina add say, if to say pipo no go begin burn burn police stations, kill-kill policemen, burn private plus public property, dis looting for no happun.”

  11. How to apply for Lagos state graduate internship programme

  12. Goment don announce reopening of schools in Lagos

  13. 'Blame me for wetin una loss during EndSARS protest violence for Lagos'

  14. Lekki Tollgate shooting: Who fit give Nigeria military command?

  15. Kano police parade 59 suspects over looting, destruction during End SARS protest

    Some of di suspects with wetin dem accuse dem say dem tiff

    Wia dis foto come from, Kano police command

    Kano Police Command on Wednesday parade 59 suspects with items dem steal during last week EndSARS protest wey happun for di northern Nigeria state.

    According to statement wey Commissioner of Police Habu Sani release, some of di items wey dem recover from di suspects include Generators, clothes, DVD players and mattresses.

    Di police officer also tok say e dey important for traditional title holders and pipo wey dey civil society to dey sensitise pipo on need to live in peace and harmony.

    E neva dey clear wen di police go carry di suspects go court over di mata.

  16. 'Na di system mess me up. No be just di police'

  17. President Buhari dey beg Nigerians not to divide di kontri

  18. Nigerian Army deny Lekki toll gate shooting, implicate Sanwo-Olu goment

  19. Magistrate Court for Port Harcourt remand 21 suspects to prison on accuse of terrorism

    Court

    Magistrate Court for Port Harcourt don remand 21 suspects to di Nigerian Correctional Centre sake of accuse of terrorism.

    Di Police wey arraign di 21 suspects for court say dem be members of di proscribed Indigenous Peoples of Biafra IPOB group wey dem arrest sake of End Sars protest wey turn violent for Mile one area of Diobu Port Harcourt and Oyigbo local goment.

    Chief Magistrate Amadi-Nna wey hear di case say im no get jurisdiction to hear di matter, come tell lawyers of di suspects to seek bail for dia clients for High Court.

    Di Chief Magistrate also order di case file to di Department of Public Prosecution for legal advice come adjourn di case to 29 December 2020.

  20. Plateau state goment relax curfew

    Plateau state goment don relax di curfew for di state.

    According to statement from di goment, "based on di assessment of di security situation in Plateau State and upon di recommendation of di Plateau State Security Council, di Executive Governor of Plateau State Simon Bako Lalong don approve di relaxation of di curfew dem impose for Jos South and Jos North Local Goment Areas with effect from Wednesday 28th October 2020.

    By dis directive, di curfew dey hereby relaxed to commence from 6am to 12 midnight beginning from Wednesday 28th October untill further notice.

    No movement go dey allowed between di hours of 12 midnight to 6am." Di statement tok.