Lekki toll gate End SARS protest shooting latest - How di world react

Di peaceful End SARS protest wey bin dey happun for Nigeria financial capital Lagos turn bloody on Tuesday night afta eyewitnesses say sojas fire live bullets enta protesters begin shoot.
Tins begin get k-leg for di peaceful well organised protest wen some jaguda pipo hijack di protests on Monday begin harass innocent civilians, attack police for Lagos and oda states.
By Tuesday morning, mata turn worse as dem burn police stations, and pipo properties.

Wia dis foto come from, Babajide Sanwo-Olu
Di katakata wey burst na im make di Lagos state govnor Babajide SanwOlu, declare dust to dawn curfew for di state on Tuesday October, 20.
But mata further sour as some of di protesters wey station for di protest strongholds for Lekki and Alausa insist on remaining for di protest ground despite di curfew.
According to pipo wey witness tins as dem happun for di Lekki protest ground plus videos wey bin go viral for social media, some sojas land di place, surround di protesters begin shoot live bullets.
Lagos goment confam say 30 pipo injure for di shooting. But e neva clear how many pipo wey die from bullet wounds.

Wia dis foto come from, Rihanna/Twitter
Army deny di attack
Despite di videos wey show men in Nigeria Army uniform dey shoot protesters, di Army deny di attack.
End of Di one wey oda users dey read well well
A few days ago, di Nigeria Army give public notice say dem go begin Operation Crocodile Tears VI starting from October, 20, 2020 reach December.
For dia Twitter handle, dem describe all di tori about di Lekki attack wey some tori pipo carry against dem say dem shoot End SARS protesters as fake news.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post, 1
How di world react
Some ogbonge pipo for di world don call out Nigerian goment make dem order a stop to di attacks.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post, 2
Dis article contain content wey Instagram provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di Instagram cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of Instagram post
"While we continue to investigate the killings, Amnesty International wish to remind di authorities say under international law, security forces only fit resort to di use of lethal force wen strictly unavoidable to protect against imminent threat of death or serious injury." Na so Amnesty International.
American musician Rihanna say, "I no fit bear to see dis torture and brutality wey don continue to affect di nation across our planets!... My heart dey broken for Nigeria man!! E dey unbearable to watch! I dey so proud of your strength…"

Wia dis foto come from, Instagram/Beyonce
Nigerian Celebs and elites too tok
Former Nigeria number three man, Senate president Bukola Saraki, "I appeal to d goment to end dis shooting of protesters by security agents. We need to exercise great patience, restraint and compassion to handle di demands of dis youth."
Oby Ezekwesili tweet say, Hello World, Our @NigeriaGov of @MBuhari dey kill our young citizens on di street for Lagos now. Join us to #StopNigeriaGovernment Now!!!
One Nigerian footballer John Ogu for Twitter say, "make di Politicians ask dia children to go and represent Nigeria for di next @NGSuperEagles , @thenff upcoming games.
For ogbonge Nigeria actress Kate Henshaw, "All na smoke screen afta all... Di more we look, di less we saw... e no take long to spill more blood!!

Wia dis foto come from, Babajide Sanwo-Olu
Sanwo-Olu visit di victims
Lagos state Govnor Babajide Sanwo-Olu say im no sabi anytin about di attack and im goment go investigate di mata.
Di govnor go visit di injured victims for hospital wia dem dey collect treatment.
For im tweet, oga Sanwo-Olu describe wetin happun as di darkest day of dia night as pipo wey dey beyond dia control "mark dark notes for our history."
"Dis na di toughest night of our lives as forces beyond our direct control don move to make dark notes for our history, but go face am and come out stronger.
I've just conclude visit to hospitals wit victims of dis unfortunate shooting incident for Lekki."












