Lagos Curfew Time: Sanwo-Olu Government declare 24-hour movement restriction afta hoodlums hijack End SARS protest

Wia dis foto come from, Other
Lagos state govnor, Babajide Sanwo-Olu don impose 24 hour curfew for all parts of di state starting from 4pm today, 20 October, 2020.
Di govnor wey make dis announcement for Twitter say na because di peaceful End SARS protest wey jaguda pipo don hijack to do evil.
Oga Sanwo-Olu say na only essential workers and first responders go fit waka for road.
He say hoodlums dey hide under di protest to disturb and cause wahala for di state.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post
Who dey affected by dis curfew?
Everybody.
Di only pipo wey no go dey affected na essential service providers and first responders. Na only those pipo dey allowed to be on di streets.








