Maurice Kamto peaceful march: Arrests, tight security, forces di watch Kamto e house as September 22 march di near

Wia dis foto come from, Kum Paul
Security forces don arrest five mimbas of 'Stand Up Cameroon' member, tighten security for Yaoundé and forces di watch Maurice Kamto CRM party leader e house.
Na de tactics weh authorities di take for stop September 22 peaceful march weh opposition leader, Maurice Kamto bin announce for call president Biya for leave pawa afta 38 years.
Maurice Kamto declare peaceful march for call president Biya for lef pawa as e no fit solve Anglophone crisis afta president Biya call regional elections.
Kah Walla leader for Stand Up, movement weh e wan bring change for political situation for Cameroon, Kamto ally, tweet alert for social media say security forces don arrest five mimbas.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post
Before now, security forces arrest Cameroon Renaissance Movement, CRM mimbas for Douala and Yaoundé, plus eight motorcycle riders weh deh say President Biya must go.
Tight security for Yaoundé
Defence Minister Joseph Beti Assomo for flash stop all holiday for army, put dem on alert in case of public disorder.
Main junctions for capital city dey laik say Cameroon di prepare for war, police put dia gear for down, shields, helmets and sticks di wait for any move.
Also, 'Black Maria' stand for some areas Central Post office, Tsinga junction. Inside town, police too di stop taxi check passengers dia ID and cargo.
End of Di one wey oda users dey read well well
For night, 30 police surround dia party house for Cameroon People Party, CPP as deh bi hold meeting, but no arrest.
Kamto's house under watch
Tori weh e enta BBC Pidgin News na say some security forces wit plain clothes don di watch Kamto e house and party house.
No bi de first taim dis di happen, as afta kamto bin declare say na yi win elections for 2018 start 'white march' security bin flop for e house and deh stop e for komot.
As goment wan stop de march, supporters for regime di condemn Kamto say kontri don get enough problems wit de fight for Anglophone regions and e no need for add problems wit march.
Some civil society, political parties, traditional rulers, di condemn de march. But, some parties don join Kamto for march tell president Biya for lef pawa as e no fit solve Anglophone crisis.
Motorcycle riders for Yaoundé and Douala komot march declare say deh no go join kamto e march.
Some traditional rulers don meet for president Biya e village, Mvomeka for make traditional rites, pray for president.
Before now Paul Atanga Nji Minister for Territorial Administration don give instructions make governors for centre, west and littoral arrest any pesin weh e komot for march.
Na so local authorities di write book for stop any kana march for dia area of command.












