Cameroon regional elections: Maurice Kamto, opposition leader and goment draw battle line

Muarice Kamto Paul Biya

Wia dis foto come from, Maurice Kamto/Paul Biya

As Cameroon President Paul Biya set December 6 for hold regional elections, Paul Atanga Nji, Territorial Administration Minister, don warn opposition parties especially MRC of Maurice Kamto say deh no go tolerate disorder.

Maurice Kamto, Cameroon Renaissance Movement, MRC opposition party leader bin tok say if goment set election date weh deh no find solution for Anglophone crisis e go start campaign for chase President Biya for pawa.

So wen President Biya put election for December 6, Kamto e tok-tok pesin say "September 22, "Cameroon Revolution", Paul Biya Must Go".

Supporters of de regime di laugh say make Kamto, weh e bin bi main challenger for president Biya for 2018 presidential election say make e act now as e own na only tok.

Atanga Nji, remind Kamto say e bi komot prison but deh nova close e case.

"I hear some parties di say some parties di make irresponsible declarations di put pre-condition for regional elections say na mischievous plan for destabilise de kontri", Ananga Nji tok

Interior boss, weh e bi in charge of law and order for kontri say deh no go tolerate any disorder.

No bi only MRC bi against de regional elections as Anglophone crisis, weh e start for 2016 di still go on just now.

De Social Democratic Party, SDF of John Fru Ndi say deh go boycott de elections if goment no revise electoral code, and declare ceasefire for Anglophone crisis.

Cameroon's People Party, of Kah Wallah also warn say deh go boycott elections if de present condition wit Anglophone crisis remain laik e dey now.

Regional elections go bi de final stage for put in place institutions and de process start for 2018, senatorial, presidential, municipal and now regional.