Coronavirus tips: WHO say Africa go get 220 million Covid-19 vaccine dose

Coronavirus tips

Wia dis foto come from, Reuters

Wetin we call dis foto, Human clinical trials for vaccines dey happun for Africa

Di World Health Organization (WHO) don say once Covid-19 special injections alias vaccine dey approved and Africa go get at least 220 million initial doses.

Di first batch go be specially for front-line healthcare workers and vulnerable groups, according to di WHO Africa Program Area Manager Richard Mihigo.

He say distribution go dey base on di population of each kontri. Mr Mihigo say all 54 kontris don show interest for di Covid-19 vaccine.

Africa get population of more than 1.3 billion pipo. Di global vaccine initiative, called COVAX, wan help buy and distribute 2 billion doses of approve vaccines by di end of 2021.

Di initiative get nine vaccine candidates wey dem dey test globally.

Two of di vaccine candidates dey currently test for Africa, according to di Coalition for Epidemic Preparedness Innovations (CEPI) boss Richard Hatchett.