JAMB: Joint Admissions and Matriculation Board dey resume Nigeria University admission afta Covid 19, see wetin go change for students

JAMB Registrar, Prof . Ishaq Oloyede

Wia dis foto come from, PrOF ISHA'Q OLOYEDE/FACEBOOK

JAMB - Joint Admissions and Matriculation Board , di goment office in charge University admission for Nigeria say from Monday 31 August, 2020 dem go begin attend to students wey get issues wit printing of admission letters, inter-university transfers and oda issues before 2020 Covid-19 pandemic.

But dem must book appointment before dem come, na wetin JAMB explain give BBC Pidgin.

Fabian Benjamin, di tok tok pesin for JAMB say before na pipo wey write and get issues wit di 2020 UTME exams and admissions dem bin dey attend to during di Covid-19 restriction.

But as Federal Goment don relax more restrictions on di COVID-19 lockdown, dem don begin attend to pipo wey get issues for oda years before 2020.

"Due to Covid-19, we decide say we no want crowd for our centres in line wit directives wey relevant agencies like di PTF and NCDC h give. We bin restrict our services only to 2020 platform.

But now wey we don exhaust services to pipo on 2020 platform, as goment ease down di lockdown, di pressure dey less so we don expand di service by lifting di suspension on oda years.

JAMB na di join bodi wey dey set exam for people wey wan go university for Nigeria.

Wia dis foto come from, JAMB/FACEBOOK

Wetin dis one mean be say if you register JAMB for 2019, 2018, 2017, 2016 like dat and you wan do any changes, print admission letter, correction of data, matter wey concern illegitimate admissions and proceses or any oda tin at all, you fit now do am."

So students wey take UTME before 2020 or apply through Direct Entry, those wey already dey University, pipo wey don graduate, any pesin wey get issue wit JAMB fit go any of dia Centres nationwide go sort am out.

But dem must comply wit all existing Covid-19 protocols and dem must book appointment for di Appointment Booking Platform wey dem fit access online from dia phones to secure a definite date and time for dia appointment before dem come.