BBNaija 2020 evicted housemate: Tolanibaj clear di air about her 'feelings' for Neo

Wia dis foto come from, Instagram/Tolanibaj
One of di latest Big Brother Naija housemates to comot, Tolanibaj say pipo dey misunderstand her feelings for Neo.
Tolanibaj bin follow Erica tok for one of dia gist say she bin dey attracted to Neo.
For interview wey Brighto, Tolaniaj and Wathoni do wit BBC News Pidgin, Tolanibaj say; "I bin tok say Neo na fine boy no be say I like am.
"I feel say Nigerians suppose understand di difference between say pesin find pesin attractive and you like di pesin,
Wetin I do na to just compliment say wow dis pesin-Neo dey attractive no mean say you wan date di pesin or you suppose date di pesin." she add.
She tok say her compliment about Neo na innocent compliment.
See di full interview with Brighto, Tolanibaj and Wathoni here:
Fans bin dey disappointed wen Tolanibaj make di comment for di live show and dem feel say she no suppose feel dat way about her friend- Vee boyfriend.
End of Di one wey oda users dey read well well
She also tok about her relationship wit Prince say dem start am just to catch cruise but she no dey clear yet wetin go happun wen Prince comot from di house.
Wen we still ask Tolanibaj who she wan make e win di 2020 edition of Big Brother Naija season, she say she go like make Prince win am.












