Nigerian man wey 'im family lock up for 30 years' get rescue

Wia dis foto come from, Human Rights Network
Police for Kano State, northern Nigeria, don rescue one 55-year-old man wey im family lock up for 30 years as dey claim say im get mental problem, na wetin human rights activist tell BBC Sani Shuaibu.
Di man don suffer for many years, one of im feet dem tie with iron to one big wood for inside room without door or window, na wetin Oga Shuaibu of Human Rights Network (HRN).
Im alert police of di man situation and join di operation to save am for one property wey dey for Rogo town.
"Im get mental problem and im bin dey very aggressive and instead of him papa to ask for help for 1990 di father decide say di best thing to do na to lock am up" na wetin Oga Shuaibu tell BBC.

Wia dis foto come from, Human Rights Network
"When di father die few years ago, im two brothers wey e im younger ones continue to keep am for detention, but today im be free man. Some neighbours dey aware of di situation and dem help for im rescue", Na wetin im add put.
Di man wey be 55 years now dey Rogo General hospital wia im dey receive treatment while police dey question im brothers.
Kano Police tok-tok pesin Abdullahi Haruna confirm di rescue to BBC and dem say dem dey investigate di case.
Dis na di third time dem dey do dis kain rescue operation in less than two weeks.
End of Di one wey oda users dey read well well
HRN, wey be non-governmental organization, follow for di three rescue operations dem. Dia oga Haruna Ayagi, tell say dem expect to see more cases because "na problem wey pipo dey ignore well-well".
"For most of these cases di parents get children with special needs and since dem no get di money to care for them and without help from di goment or institutions, dem decide to lock dem up, "na wetin im add put.















