Lagos missing children: Five pikins miss inside Otto community between Jan. 2019 and now
Five pikin go missing for Otto community, Lagos.
Dem be pikin between di age of two and four years old. Dia parents say dey tiff dem outside of dia domot.
Di first case happun fot January of 2019 and di mother still dey feel di pains of dia lost babies.
Residents of Otto, Ebute-Metta area of Lagos State say children dey fall into di hands of kidnapping inside di community with at least five kids already missing.
Di pikins wey dem identify include; Dunmola Ogunjobi, age four; Aisha Taiwo, age four; Daniel Samuel, age three; Alimat Onikoyi, age four and two-year-old Romanus.
Dem share dia pains with BBC Pidgin.
