Nigerian woman wey kidnappers dump inside soakaway pit for days get rescue but many surprise say Chizoba Eke still dey alive
Pipo for Igwuruta, Ikwerre Local Goment Area of River State surprise as dem bring out ONE woman, alive from soakaway pit wia kidnappers bin dump her for three days.
Na on Monday 17 August, 2020 kidnappers gbab Mrs. Chizoba Eke and her six months old pikin from wia dem dey live for Igwuruta.
Tori pesin and eye witness wey see korokoro wen dem bring out di woman from di soakaway pit, Awajis George tell BBC Pidgin say di kidnappers dump her inside one soakaway pit come comot wit her six months old pikin.
But yawa come gas for one of di kidnappers head wen police catch am for police stop-and-search point wit di pikin for Omerelu wey be di boundary between Rivers and Imo State for southern Nigeria.
Police come invite Chizoba husband, Eke Eke to come identify di pikin as im bin don lodge complaint wit dem about im missing wife and pikin and di suspect wey dem arrest come show di soakaway pit wia dem bin don dump her.
Pipo surprise say she still dey alive wen dem bring her out as she don stay inside di soakaway out for three days and she dey hospital now dey receive treatment.
Police Atok tok pesin Nnamdi Omoni confam di tori to BBC Pidgin come add say dem don arrest one of di suspect wey dey help dem wit di investigation for di matter and di woman dey receive treatment for hospital




