Bundu Ama: Di community wey get only 'one' toilet
Bundu Ama wey dey very close to di Port Harcourt Correctional Centre na one of di biggest waterside community for Port Harcourt City, Rivers state, Nigeria.
With population of over 200,000 pesins wey dey live dia, many of di pipo dey poo-poo outside because di community no get better toilet.
70 year old Mama Adaoma Maxwell wey don live for Bundu Ama over 20 years tell BBC Pidgin say na for 2012 dem build di only free general out-toilet for di waterside through community effort and do some small repairs five years ago, but since dat time dem never fit renovate am as many pipo no gree contribute.
Many goments for di State don promise to build better toilet for di community but dem never see anytin.
Producer: Karina Igonikan




