Waec physics practical: West Africa Examination Council reply physics practical 2020 postpone rumour in Nigeria

Waec physics practical
Wetin we call dis foto, Waec Physics practical na im thousands of final year secondary school students wey wan study science go write on Thursday for Nigeria for di on going SSCE.

West Africa Examination Council don reply physics practical 2020 postpone rumour wey dey fly upandan for Nigeria.

Di rumour follow one letter from Waec office for Freetown Sierra Leone dated 18 August, 2020 wey tok say dem go shift di exam wey suppose hold on Thursday 20 August, to now hold on Friday 28 August from 2pm to 4:45pm.

waec physics practical

Wia dis foto come from, Twitter

Wetin we call dis foto, Dis na di waec physics practical letter wey dey fly upandan for social media

But Waec Nigeria office don clear di mata say dis letter no concern candidates in Nigeria.

Waec even reply message for dia Twitter page on Wednesday 19 August, to make am clear say di two and a half hour exam practical go still hold as dem put for dia latest West African Senior School Certificate Examination for School Candidates, 2020 Final International Timetable.

waec physics practical

Wia dis foto come from, WAEC Nigeria

According to di time table, di Physics Alternative D (Alternative to Practical Work) go still hold between 9:30am and 12:15pm on 20 August for Nigeria.

So Waec Physics practical na im thousands of final year secondary school students wey wan study science go write on Thursday for Nigeria for di on going SSCE.

Waec physics practical
Wetin we call dis foto, Students for exam centre on Monday
Waec physics practical
Wetin we call dis foto, Students for Community Secondary School Ogbogoro, Rivers State

Ova 1.5 million final year secondary school students for Nigeria start dia West African Certificate Exams WAEC on Monday 17 August, 2020.