Walter Carrington: Former US Ambassador to Nigeria don die

Wia dis foto come from, Getty Images
Former United States Ambassador to Nigeria Walter Carrington don die.
Inside statement wey im Nigerian wife Arese Carrington sign, she say her husband Oga Carrington die on Tuesday, but she no tok wetin kill am.
Madam Carrington say: "im die peacefully wit im family members around am at di age of 90 years on Tuesday, August 11, 2020,"
Who be Walter Carrington?
Dem born Ambassador Walter Charles Carrington on July 24, 1930 for New York. Im parents Marjorie Irene Hayes ans Walter R. Carrington bin migrate from Barbados.
Walter Carrington na US diplomat wey serve as American Ambassador to Senegal and Nigeria.
He serve as Ambassador to Senegal from 1980 to 1981 for president Jimmy Carter goment.
For 1993, US president Bill Clinton appoint am as Ambassador to Nigeria.






