Unilag VC sacked: Professor Oluwatoyin Ogundipe dismiss 'Wale Babalakin Council removal' insist say im still remain University of Lagos Vice Chancellor

Wia dis foto come from, Professor Oluwatoyin Ogundipe
University of Lagos (Unilag) don deny report wey dey spread say dem don remove di school Vice Chancellor, Prof. Oluwatoyin Temitayo Ogundipe.
Some local media bin cari report say di university governing council remove Oluwatoyin Ogundipe as di vice-chancellor of di school earlier on Wednesday.
All wetin dey happun dey follow months of infighting within di management of di University of Lagos.

Wia dis foto come from, PIUS UTOMI EKPEI/AFP/GETTY IMAGES
Professor Oluwatoyin Ogundipe led University Senate and Wale Babalakin led University Governing Council inside di University of Lagos don dey get leadership tussle for a long time.
By di rules of di federal university, di governing council na im dey oversee di management of di University wey Prof. Ogundipe dey in charge.

Wia dis foto come from, UNILAG
But for one statement wey Professor Oluwatoyin Temitayo Ogundipe sign dem deny di rumour and say na anyhow imagination of di pesin, Oladejo Azeez wey dey spread am.
"Notice to di General Public on di Removal of di Vice Chancellor, University of Lagos by Oladejo Azeez, Esq" di statement tok
- See WAEC timetable for di 2020 examination wey go begin August 17"Di attention of di University of Lagos (Unilag) management don dey drawn to di; 'Notice to di General Public on di Removal of di Vice Chancellor, University of Lagos'; dated August 12, 2020 and signed by Oladejo Azeez, Esq, Registrar and Secretary to Council, stating say dem don remove di current Vice Chancellor, Professor Oluwatoyin T. Ogundipe, FAS from office with immediate effect." "Dis no be true and na figment of im imagination. Therefore, we dey advise stakeholders of Unilag and di general public to disregard dis mischievous disinformation about di sitting Vice Chancellor of Unilag, contained for dat notice. "
"Professor Ogundipe still remains Unilag Vice Chancellor. "
End of Di one wey oda users dey read well well

Wia dis foto come from, UNILAG
Na for November 2017 na im di 60 year old Professor Oluwatoyin Temitayo Ogundipe collect appointment as di number 12 substantive Vice Chancellor for University of Lagos.












