Obadiah Mailafia on Boko Haram: Central Bank of Nigeria ex-deputy governor 'allegation' for radio station attract DSS - See key points from Mailafia interview

Obadiah Mailafia on Boko Haram

Wia dis foto come from, Facebook/Obadiah Mailafia

Wetin we call dis foto, Obadiah Mailafia
Read am in 2 mins

Obadiah Mailafia, former Deputy Govnor of di Central Bank of Nigeria, recent radio interview on Boko Haram na im dey cause serious gbas gbos for social media now.

Di main tin wey Dr. Mailafia tok na allegation say some terrorists wey repent say one northern Nigerian govnor for di kontri be leader for di Boko Haram terrorist sect.

As e be so, di Department of State Services (DSS) for di kontri don invite oga Mailafia, ova im claim.

Di former CBN deputy govnor make di claim for one radio interview for di 'Morning Crossfire' programme on Nigeria Info Abuja 95.1FM on Monday.

Im reveal some oda serious allegations wey fit shake di kontri.

Obadiah Mailafia on Boko Haram

Wia dis foto come from, Obadiah Mailafia

Wetin Obadiah Mailafia tok on Boko Haram?

Di former CBN deputy governor say e chat wit two repentant terrorists wey identify di northern governor.

Dr Obadiah Mailafia tok say during di lockdown, di Boko Haram insurgents bin dey move and distribute arms and ammunition across di kontri anyhow.

"During dis lockdown dia planes bin dey move up and down as if lockdown no dey." Oga Mailafia tok

"Dem bin dey move ammunition, move money, and dem dey distribute dem across different parts of di kontri."

E tok say dem meet wit di Boko Haram top commanders.

E say, "Some of us also get our intelligence networks. I don meet wit some of di bandits; we done meet wit some of dia high commanders - one or two wey done repent-, dem sit down wih us not once, not twice," im tok

E say di terrorists and bandits be one and di same.

"Dem tell us say one of di northern governors be di commander of Boko Haram in Nigeria. Boko Haram and di bandits na one and dem be di same.

Pipo for social media don also dey react to di mata.

One Security and Conflict Analyst, Bulama Bukarti tok for im Twitter handle say make di DSS investigate Obadiah Mailafia claims.

Bukarti say na di right step and e must be fully transparent. Nigerians suppose dey informed.

Skip X post, 1
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of X post, 1

Skip X post, 2

End of X post, 2

Skip X post, 3

End of X post, 3

Who be Obadiah Mailafia

Dem born Obadiah Mailafia for 24 December 1956 and im be 63 years old.

Oga Mailafia na former Central Bank of Nigeria deputy governor and im be Development Economist & Consultant.

Im also be former official of di African Development Bank Group.

Obadiah Mailafia on Boko Haram

Wia dis foto come from, Facebook/Obadiah

Wetin we call dis foto, Obadiah Mailafia

Im be former Presidential candidate of African Democratic Congress ADC in di last election.

Oga Mailafia don confam to local tori pipo, Punch say DSS invite am on Tuesday and im go go dia office in Jos, Plateau state, on Wednesday.