UK in recession for first time since 2009 - See how e fit affect you

Wia dis foto come from, Getty Images
Di UK economy don drop to im lowest point for di first time in 11 years as di kontri officially enta recession. And dis fit mean serious tins for many pipo, home and abroad.
Di economy reduce by 20.4% compared wit di first three months of di year.
Money families carry dey buy tins drop as shops begin close, while factories and construction also reduce dia output.
Di Office for National Statistics (ONS) say closing of shops, hotels, restaurants, schools and car repair shops also cause collapse.
Dis one push UK into im first recession - wey be economy no ginger for two back to back quarters - since 2009.

Wetin go be di impact of dis UK recession?
Jobs / Money
Some pipo fit lose dia jobs, or dem fit see say promotions no go come, or salary just remain (or even reduce). For Africa families, wey get pesin abroad, dis fit be issue, as most kontries go first favour dia citizens before foreigners.
If Africans for UK no see business do, or dem no get work again, na only matter of time before money wey dem dey "send home" stop.
End of Di one wey oda users dey read well well
Dem fit even begin ask dia families back home for support.
Education / Graduates
African students wey wan go UK to study fit see say tins like grant and scholarship no dey like before. During di 2009 recession, UK schools cut di amount of money dem use to epp new students.
School fees too fit increase.
And for UK graduates sef fit see say inside recession, e dey hard to get first job. And for those wey wan enta school, di recession fit make dem postpone till later-later as assurance no dey for money to run am.

Wia dis foto come from, Nigeria Immigration Service
Visa
E no dey clear if price of UK visa go increase or even reduce. Or if di recession go make am hard for foreigners to get visa to Britain.
Poverty inheritance
Sabi pipo don torchlight say poverty wey recession dey cause some families fit pass don to generations under dem. Dis na because sometime e dey hard for di family to recover and di poverty go pass to dia pikin dem.
Property
Price of UK property fit reduce, as many pipo need money and dis go benefit foreign investors - even from Africa. But sabi pipo say house owners fit decide not to sell. So na 50/50. See why below.

Wia dis foto come from, PA Media

Wetin happun for di last recession - for 2009?
Di pain of recession no balance for everybody. That is to say, everybody suffer no go equal; in fact some fit no suffer at all.
For instance in 2009, many UK homeowners wey manage to keep dia job for di recession benefit later when di economy recover.
Also, mortgage interest payments (small-small money to pay for house) reduce well-well, and dis one cause pipo to have more spend money.
But those wey dey depend on benefit from goment or for public workers dem, di recession pinch dem for body, no be small.














