Kamala Harris believe Biden accusers? Trump donate give Joe Biden running mate? Kamala Harris na cop? See wetin to know about Democrat party Vice Presidential candidate

Kamala Harris

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Kamala Harris

Kamala Harris na Joe Biden vice presidential running mate.

Di Democratic presidential candidate name Senator Kamala Harris as im running mate on Tuesday.

Harris na di first black woman to serve for dis role.

Once a rival for di top job, di California senator of Indian-Jamaican heritage don dey long time among pipo wey dem consider her as di front-runner for di position.

Di former California attorney-general don dey call for police reform amid anti-racism protests.

Kamala Harris

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Kamala Harris standing in front of an American flag

Oga Biden go face president Donald Trump for di election on 3 November.

Vice-President Mike Pence still remain di Republican incumbent running mate.

Oga Biden tweet say e get di great honour" to name Madam Harris as im running mate.

E describe her as "fearless fighter for di little guy, and one of di kontri finest public servants".

E tok about how she don work closely with im late son, Beau, wen she be California attorney general.

"I watch as dem take di tmbig banks, lift up working pipi, and protect women and pikin from abuse," e tweeted.

"I dey proud then, and I dey proud now to get her as my partner for dis campaign."

Madam Harris wey be 55 years old, na someone wey pipo dey see as rising star within di Democratic party, She drop out of di presidential race in December.

She don repeatedly clash with oga Biden during di primary election debates, mostly especially criticising im praise for di "civil" working relationship e get with former senators wey favoured racial segregation.

Kamala Harris

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, US Senator Kamala Harris

Who be Kamala Harris?

Dem born di Democra for Oakland, California to two immigrant parents: one Indian-born mother and Jamaican-born father.

She go on to attend Howard University, one of di kontri preeminent historically black colleges and universities. She don describe her time there as among di most formative experiences of her life.

Ms Harris say she don always dey comfortable wit her identity and simply describes herself as "an American".

For 2019, she tell di Washington Post say politicians no get to fit into certain positions sake of dia colour or background. "My point be say: I I be who I be. I dey good wit am. You go need to figure am out, but I dey fine with am," she tok.

Kamala Harris parents

After her parents divorce, Ms Harris na her Hindu single mother na im mainly raise her.

Her mama na cancer researcher and civil rights activist.

She grow up attached to her Indian heritage, dey join her mother on visits to India, but Ms Harris don tok say her mother adopt Oakland black culture, involving her two daughters - Kamala and her younger sister Maya - inside di culture.

"My mother understand wella say she she dey raise two black daughters," she write for her autobiography The Truths We Hold.

"She know say her adopted homeland go help Maya and me as black girls and she bin dey determined to make sure say we grow into confident, proud black women."

Kamala Harris

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Kamala Harris

Wetin be her record?

Afta four years for Howard, Madam Harris move on to earn her law degree for di University of California, Hastings, and begin her career for di Alameda County District Attorney Office.

She likes later come become di district attorney - di top prosecutor - for San Francisco in 2003, before Dem elect her as di first woman and di first African American to serve as California attorney general, di top lawyer and law enforcement official in America most populous state.

During her nearly two terms in office as attorney general, Madam Harris gain beta recognition as one of di Democratic party rising stars, she use dis moment to pusg her election as California junior US senator in 2017.

She tier rubber her candidacy for president to plenti crowd of more than 20,000 inside Oakland for di beginning of last year.

But di senator fail to Tok about her clear plan for her campaign, and no give clear answers to questions for key policy areas like healthcare.

She also not fit use di her clear high point of her candidacy wella: day na debate performances wey showe off her prosecutorial skills, wey always put Biden for di line of attack