Big Brother Naija Dorathy and Lucy table Nengi, Ozo, Brighto oda housemates mata for BBNaija Lockdown - Day 23 highlights

Big Brother Naija Dorathy and Bright

Wia dis foto come from, BBNaija Twitter

Wetin we call dis foto, Dorathy and Brighto
Read am in 2 mins

Big Brother Naija housemate Dorathy don reveal wetin she and Brighto bin discuss during dia Saturday night party for di house ova di weekend.

'Brighto say im love me' dat na wetin Dora tell Lucy as two of dem lie down for di garden on Tuesday morning. She say Brighto tell her say im tell Biggie for Diary Room.

According to her, she and Brighto bin get dia moment for di party wia she tell am say: "I go like kiss you." Brighto ask her wetin make her feel like dat she say she no know.

But she say she know no weda na because of di kiss mata or im actually mean am.

Dora and Brighto neva declare any feelings for each oda before now for di house, Lucy shock wen she hear di gist.

Di only love interest wey dem don link Dorathy with for di house na Ozo, but she say two of dem na just friends and nothing more.

Still ontop di Brighto mata she tell Lucy say two of dem agree say dem no go dey eat togeda, hold hands on dey play love like oda couples dey do for di house.

Dora even share with Lucy wetin happun between she and Brighto last night tori be say, wen she bin dey go bath, Brighto ask her if him fit join her and she play along and agree.

'I no tok say I love Lilo before' - BBNaija Eric

BBNaija Eric

Meanwhile evicted BBNaija housemates Eric and Tochi follow BBC Pidgin tok for di first time afta im eviction from di Big Brother Naija Lockdown House.

Eric admit say im bin no prepare wella compared to oda housemates wey still dey di house.

Watch di full interview here:

Skip Facebook post

Content is not available

View content on FacebookDe external site no concern BBC.

End of Facebook post

Wetin Lucy tok about Ozo,Dorathy,and Nengi triangle?

Big Brother Naija Lucy and Dorathy

Wia dis foto come from, BBNAIJA Youtube

Wetin we call dis foto, Lucy and Dorathy

Di gist move enta Ozo, Dorathy and Nengi triangle and Lucy advise Dorathy to remove herself from di equation.

She say na wetin cause di fight between herself and Lucy until e become personal. She say she wonder why Nengi go think say she no go get mind to tok anything for her face.

"Dem evict her new target on Sunday and she bin dey plan her next move. I only feel bad for Prince because im bin don dey fall and im be my friend," na wetin she tok.

Dis week 14 housemates dey up for possible eviction na only di head of house Erica and her deputy Kiddwaya wey get immunity.