Brewery explain why dem name beer 'pubic hair' for Maori

One file picture of a pint of beer

Wia dis foto come from, Reuters

Wetin we call dis foto, Di Canadian company say dem use di word to mean say dia beer dey "as light as a feather".

One Canadian brewery don tok sorry say dem no mean am as dem name one of dia beer afta one Maori word wey pipo sabi as pubic hair.

Hell Basement Brewery for Alberta say dem release dia Huruhuru beer two years ago, and dem tink say e mean "feather".

But one Maori TV personality Te Hamua Nikora explain di common interpretation of di word for inside Facebook video.

Di brewery founder say dem go rebrand di product.

"We agree say we no reason on how pipo dey take use di word huruhuru say e dey refer to pubic hair, and if to say we follow Maori representative tok e for beta pass di online dictionaries we use," Mike Patriquin tell Canadian network CBC.

"We wan make am clear say we no get am for mind to offend di Maori culture or pipo in any way; to those wey feel disrespected, we apologise."

Oga Nikora also accuse one leather store for New Zealand wey use di name Huruhuru, he say im bin contact di store and brewery on top dis mistake.

"Some pipo call am appreciation, I call am abuse," he tok.

"Na dat entitlement disease dey get. Stop am. Use your own language."

Tok tok pesin for di New Zealand leather store tell RNZ news site say dey no mean any offence by di name, dem bin reason say di word mean wool, or feather or fur.