Victor Osimhen: Nigeria striker don become di most expensive player for Africa after Napoli confirm dia deal

Nigeria striker Victor Osimhen in action for Lille

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Nigeria striker Victor Osimhen start im European career for Germany at Wolfsburg
Read am in 2 mins

Italian Serie A side Napoli don confam di signing of Nigeria striker Victor Osimhen from French club Lille.

According to French sports newspaper L'Equipe di deal worth more than $96 million (81.3m Euros) wey make am di most expensive African player of all time.

Napoli don pay pass wetin English side Arsenal pay Lillie for Ivory Coast Nicolas Pepe last year.

Osimhen join Lille from Belgium Charleroi to replace Pepe.

He score 18 goals for all di competitions for Lille last season.

Skip X post, 1
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of X post, 1

For some weeks now na im pipo don dey reason say Napoli go sign di 21 year old.

Nigeria Striker Victor Osimhen go begin play for Italian club Serie A

Wia dis foto come from, VICTOR OSIMHEN/INSTAGRAM

Wetin we call dis foto, Nigeria Striker Victor Osimhen go begin play for Italian club Serie A

For June, dem name Osimhen player of di season for Lillie. For im first campaign for France, dem also give am Ligue 1 team of di season.

See as Victor Osimhen football career take waka

Osimhen bin enta spotlight for 2015 Under-17 World Chile as he win di Golden Boot and Silver Ball awards wen e still dey play for Golden Eaglets..

Di 16-year-old score tournament record 10 goals, and e play well wey make am win di award for Africa Youth Player of the Year for 2015.

Di international footballer performance for Chile World Cup carry am go Wolfsburg but Osimhen no play for Arsenal instead im play in Germany Bundesliga. He tok say e no easy to dey play for both league and European football but im dey try adjust.

Nigerian Striker Victor Osimhen

Wia dis foto come from, @sscnapoli

Wetin we call dis foto, Nigerian Striker Victor Osimhen

For one season di striker no play sake of injury, he later move go Belgium wia im begin dey score more goals. He score 19 goals for Charleroi Belgium, where he dey on loan before dem permanent am.

Victor Osimhen tweet im no fit wait to wear di jersey and change na constant thing. He add say im dey sure say im mama and dey proud

Skip X post, 2
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of X post, 2

Many of im fans don enta social media to congratulate am.

Skip X post, 3
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of X post, 3

Skip X post, 4

End of X post, 4