Adebayo Akinfenwa: Wycombe Wanderers F C striker get Jurgen Klopp special message for crossing EFL League one

Adebayo Akinfenwa, Wycombe Wanderers Football Club star

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Championship go see 'Beast mode' next season

Wycombe Wanderers Football Club players belle dey sweet dem afta dem secure promotion to di Championship, dem beat Oxford United for Wembley - but only one of dem get to celebrate dia victory with Liverpool manager Jurgen Klopp.

Afta di Chairboys 2-1 victory on Monday to reach di second tier for di first time, veteran striker Adebayo Akinfenwa tell tori pipo Sky for interview for pitch, wia di 38-year-old tok about one similar post-match interview from am four years earlier.

On dat day for 2016 - afta im score penalty for AFC Wimbledon against Plymouth Argyle for League Two play-off final - Akinfenwa tok say: "I think I dey unemployed, so any manager fit hit me up for WhatsApp to give me job."

So afta last night result, Akinfenwa, wey be long-time Liverpool fan, begin joke say: "Make I tell you sometin, di only person wey fit hit me up on WhatsApp dis time na Klopp, so we fit celebrate together. You get me? Oi!"

Like play like play Klopp do am.

For video call, Klopp explain tok say im watch di game, but miss di post-match interview. But, , "Hendo and some of di oda boys" tell me about am.

"Even for dis strange times, I hope say im fit celebrate well," Na wetin Klopp tok for inside video. Na so oda Liverpool players follow send am congratulations, including Virgil van Dijk and Jordan Henderson himself.

Akinfenwa former clubs AFC Wimbledon, wey no dey limited to, Torquay, Swansea, Northampton, Gillingham, Doncaster and Millwall celebrate am for im goal scoring ability. Im nickname na 'The Beast' and im even don write autobiography wey im title 'The Beast: My Story'.

But tori be say The Beast na fan of newly crowned Premier League champions Liverpool.

Wen di Reds win dia first league title for 30 years last month, im happily chop fine from im club afta im wear LFC shirt come training for Wycombe.

And e be like say dem don reduce di fine sake of im performance on Monday: Di coach tell me say im go reduce my fine to half if gain promotion, but e go sweet me die if we go up, I go gladly pay di full amount. "E go be money well spent."