Wizkid three albums wey give am mouth as 'Afrobeat giant'

Wizkid

Wia dis foto come from, Instagram/@wizkidayo

    • Author, Faith Oshoko
    • Role, BBC Pidgin

Wizkid, Ayodeji Balogun, don create beta name for imself and African music from di time wey im release im first hit single for 2009.

Even as at now, wey pipo dey wonder wen 'Made in Lagos' im new album go comot afta di last one 'Sounds from the other side', im fan base still dey im back gidigba.

As dat one still dey come, e release EP for December 2019, wey im call Soundman Vol. 1 to make im fans cool temper.

However, on 16 July wey be im birthday, pipo don ginger again on top di album wey im don promise im fans since 2018.

But as dat one dey happun, we say make we take una back to im three albums wey im don do since im begin im career.

Superstar

Wizkid

Wia dis foto come from, Twitter/@wizkidayo

Dis album drop for 2011 and e feature gbedu like Holla At Your Boy, Love My Baby and Pakurumo. Before den im don dey enjoy plenti airplay with im songs like Tease Me and Don't Dull.

Na di same year wey im win di award for di Next Rated for di Headies, MOBO wia im win Best African Act and also collect nomination for di MTV Europe Music Awards. And for 2012, e win di BET International Act Africa.

Ayo

Wizkid

Wia dis foto come from, Twitter/@wizkidayo

Im drop Ayo for 2014 afta im don establish imself well-well for di industry.

Na for dis album, im release in popular banger, Ojuelegba and di 19 track album bin flow from reggae tunes like Joy, to gbedu wey im release with Femi Kuti, 'Jaiye-Jaiye' to even love songs like 'In Love' wey im sing with Seyi Shay.

E carry di album win di Headies for Best R&B/Pop Album for 2015 and Song of di Year for Ojuelegba.

Sounds from the other side

Wizkid

Wia dis foto come from, Instagram/Wizkidayo

Wetin we call dis foto, Na around wen im release SFTOS na im sell out one iconic venue for London

Dis na one of im most popular albums wey blow scata for obodo oyibo on top say e feature international musicians dem ontop im afro music.

Artistes like Drake for Come Closer, Chris Brown for African Bad Gyal and Trey Songz for Gbese na im feature.

Dis album na also di first album wey im release afta im comot from di EME record label wey Banky W bin dey run.

Around dat time, for 2017, Wizkid get im first Award for Grammy as Drake win Album of di Year for im album 'Views'.

Wizkid bin get writing credits for di album for im work for inside di hit song, One Dance.