When Wizkid start to dey wear mask?

Wizkid debut ontop runway for Milan

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Wizkid debut ontop runway for Milan

Wizkid no wan hear word again. As e don turn international, e wan take ova evri wia.

Ova di weekend, Wizkid waka for runway for Dolce and Gabbana and im catch a lot of attention.

Apparently na di co founder of di brand Stephano Gabbana style am.

While na di first time e dey do runway, no be di first time e go advertise clothes after im join bodi show for di release of di Super Eagles kit.

Wizkid

Wia dis foto come from, Victor VIRGILE

Wetin we call dis foto, Wizkid comot di mask afta sometime

Oda Nigerians wey follow walk di run way na Nigerian British rapper Tinie Temah and model Davidson Obennebo.

On top everi tin wey im wear, im join im mask for di mata.

Dis mask start to dey steady for im face when im do im London O2 concert wey sell out.

E launch di mask for im O2 concert wey im sellout

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, E wear mask for di second time for di O2 arena concert wey im sellout

But where e from start?

Tori be say e start to dey wear mask dis year when im show for Davido concert wey im do for UK.

But for dat concert no be di shine-shine mask im wear, na one black mask wey cover im face only leave im mouth and eyes for outside.