Wizkid New Year celebration with Cameroon Biya family cause controversy

Wizkid and Brenda Biya

Wia dis foto come from, Instagram/@brenda.officiel

Read am in 1 mins

Pipo for Cameroon di hala ontop tori say First Lady Chantal Biya and daughter Brenda Biya invite famous Nigerian musician, Wizkid, for private concert during di New Year celebrations.

E no clear wen di concert happun but di video wey go viral on New Year day, show di 'party' for Unity Palace.

Meanwhile Wizkid himself bin don post earlier on for Instagram say im dey go Cameroon.

Skip Instagram post
Allow Instagram content?

Dis article contain content wey Instagram provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di Instagram cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of Instagram post

Before now, First Lady for yi number 49 born day for December, bin invite anoda musician Singuilla for perform for Unity Palace.

Even though President Biya and Chantal send 100 truck load of tins for pipo weh deh run from fighting go oda areas for kontri for end of 2019 inside ceremony wey Ministry of decentralisation organise, some kontri pipo still hala how dey fit di spend plenty moni for party chop life wen some pipo no fit even get chop.

Skip X post, 1
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of X post, 1

Skip X post, 2

End of X post, 2

Cameroon dey face Anglophone crisis wey start for 2016. Till today, de situation still wowo for ground, about 600,000 pikin dem komot for school, 500,000 run go oda areas for kontri, 33,000 pipo go Nigeria.