Audrey Aboula: 2016 Miss Cameroon pageant contestant tok e suffer for new book

Audrey Aboula

Wia dis foto come from, Audrey Aboula

Wetin we call dis foto, Audrey Aboula as she hold e book for hand

Fine girl, plenty suffer! Dis book so di tok na about weti weh one contestant go through as e wan for be Miss Cameroon.

Audrey Aboula tell BBC Pidgin tori person Leocadia Bongben de kain suffer weh some members dem for Miss Cameroon Organising Committee, (Comica) make am suffer.

"De thing be don reach wan kain level laik say na sick. Deh mock me for Whatsapp group...change ma name, Aboula become na 'Ebola'," na weti she tok.

Aboula expose some thing dem weh pipo no di suspect for dis Miss Cameroon competition - de pageant deh among de kain big celebration for woman beauty.

But from Aboula e tori, pipo de see say fight for small and big fish dey inside di mata, like dolphin weh e enter inside shark-killer fish dia world.

Aboula, 22, na de number 1, after de Miss Cameroon winner for 2016 . Dis level three political science student, 'stronghead' girl weh bisham second position for seka say Comica member dem threaten am. How weh e no be understand reason for dis problem, e family tell e make e resign.

Di eight-chapter book comot after weh Miss Cameroon 2017 just end for December and now so some scandals don di turn-turn for social media how organisation for Miss Cameroon deh bring shame.

Na Caroline Aimee Nseke win Miss Cameroon 2017 for December 30; First Lady e self, Mama Chantal Biya put de crown for e head as most beautiful girl for Cameroon.