Akeredolu: Ondo state Governor don test positive to coronavirus - See di places im visit before e catch am

Wia dis foto come from, Rotimi Aferedolu/Facebook
Ondo state govnor Rotimi Akeredolu don test postive for coronavirus.
Di govnor wey announce am ontop im twitter page don proceed on self-isolation as per di advice of im doctors.
Di govnor say im bin get malaria some days ago and dem treat am. Im say im colleague advise am to do Covid-19 test and di result come out on 30th June, 2020 and im test positive.
"I dey asymptomatic, I no dey feel sick and I no dey feel one kain, but my doctors don decide say make I take normal treatment and self-isolate."
"Make I assure our pipo say as you dey see me, many pipo dey like dis wey no dey show symptoms, in a few days time I go take anoda test. Make I assure our pipo say di work dey go on fine." Akeredolu tok.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post
Govnor Akeredolu don join di list of govnors for Nigeria wey don catch di virus.
Oda govnors wey bin don get Covid-19 na Govnor Nasir El-Rufai of Kaduna state, Govnor Okezie Ikpeazu of Abia state, Govnor Seyi Makinde of Oyo state and Govnor Bala Mohammed of Bauchi State and former Oyo state Govnor Abiola Ajimobi wey don die.
Places wia di govnor visit recently
Before im declare say im dey positive for coronavirus, di Ondo state govnor bin attend some events and e also meet plenty pipo as im dey prepare for im second term election agenda.
End of Di one wey oda users dey read well well

Wia dis foto come from, Rotimi Akeredolu/FACEBOOK
- June 20
Arakunrin Akeredolu bin go Lagos state to attend di burial ceremony of di wife of Lagos-based pastor and founder of Trinity House, Pastor Ituah Ighodalo wey die for Port Harcourt, south south Nigeria.
Na few family members and friends attend di burial ceremony because of di coronavirus.
Among dem na di immediate family members of Ibidun and some friends of di family like di former Emir of Kano Sanusi Lamido and former Govnor of Ogun state, Gbenga Daniel.
- June 19
Di govnor bin receive Ondo State Council of Obas ahead di October 10, 2020 governorship election for di state.

Wia dis foto come from, Rotimi Akeredolu/FACEBOOK

Wia dis foto come from, Rotimi Akeredolu/TWITTER
Di Olowo of Owo, Oba Ajibade Gbadegesin Ogunoye ; Olufon of Ifon Oba Israel Adeusi,JP ; Olute of Ute, Oba Oluwole Akinrogba; Oludogun of Idogun, Oba Moses Bakare; Olumoru of Imoru, Oba Rotimi Obamuwagun; Oniyere of Iyere, Oba Omotunde Alaba Adako and Asuada of Isuada, Oba Oluwafemi Adeluwoye, Oloba of Uso, Oba Ademola Adebiyi Oyinlade; Elemure of Emure, Oba Simeon Adedubaje Adeyefa and Olupene-elect, Prince Ebenezer Ogunmolasuyi bin gada for di palace of Olowo of Owo to give di govnor royal blessing.
- June 16
Govnor Akeredolu travel go submit im nomination and expression of interest form for di APC National Secretariat for Abuja, FCT.

Wia dis foto come from, Rotimi Akeredolu/FACEBOOK
Di Minister of State for Niger Delta Affairs, Tayo Alasoadura, members of di House of Representatives, twenty-one members of di Ondo State House of Assembly and other bigwigs for di All Progressives Congress (APC) join am for di secretariat.
Di govnor also meet wit President Muhammadu Buhari as e present im expression of interest form for second term as govnor for di state house, Abuja.

Wia dis foto come from, Rotimi Akeredolu/TWITTER
- June 15
Di Ondo state govnor visit Oba Nla area for Akure, di state capital wey fire incident happun.

Wia dis foto come from, Rotimi Akeredolu/FACEBOOK
- June 12
He receive members of di delegation wey contribute money wey e carry buy im expression of interest and nomination forms to contest for di October 2020 Ondo election.

Wia dis foto come from, Rotimi Akeredolu/FACEBOOK













