Madagascar coronavirus cure 'covid-organics tonic' don land Nigeria from Guinea Bissau

Wia dis foto come from, Other
Nigeria on Saturday finally receive Madagascan native formular herbal drink against COVID-19 pandemic.
President Muhammadu Buhari formally welcome di drink from President of Guinea Bissau, Umaro Sissoco Embaló wey carri am visit di Nigerian leader for im domot - Aso Rock, State House, Abuja on Saturday afternoon.
Presido Buhari insists say im go listen to science before allowing Nigerians to take traditional or any new medicines.
"I go listen to science. We get our institutions, systems & processes inside Nigeria. Any remedy we go send am for verification. I no go use am without dia endorsement."

Wia dis foto come from, Presidency
Na since wen Nigeria say dem dey expect di Madagascar Covid-Organic herbal medicine na im goment also make am clear say di kontri go submit di drug to standard pharmaceutical tests.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post
Madagascar send dia Covid-Organic herbal medicine to Guinea Bissau for West-Africa kontris to go pick up di 'miracle herbal drink'
Madagascar President Andry Rajoelina dey promote as cure for coronavirus.







