Coronavirus - Virus: Wetin we sabi about suspected Covid-19 case of one Indian for Lagos, Nigeria

NCDC wey be di join-bodi of doctors and specialist wey dey fight di coronavirus for Nigeria on Tuesday night say most pipo wit Covid19 experience mild illness and recover

Wia dis foto come from, NCDC

Wetin we call dis foto, NCDC wey be di join-bodi of doctors and specialist wey dey fight di coronavirus for Nigeria on Tuesday night say most pipo wit Covid19 experience mild illness and recover
Read am in 2 mins

Health officials for Lagos, south west Nigeria say one Indian citizen wey get symptoms of coronavirus dey for isolation with dem.

Although di first test for Covid-19 dey negative, di Lagos State ministry of health say dem go torchlight im case again on Wednesday morning.

Di Indian national na man, and doctors say im dey do well inside isolation ward where dem keep am but dem go review im condition.

Lagos wey be di commercial capital of Nigeria na di only State out of Nigeria 36 federated states wey get confam cases of di Covid-19 virus.

So far Nigeria don get three confam cases of di Covid-19 disease but kontri pipo dey fear say authorities need to doo more to ensure say no hidden case dey for town, especially for Lagos wia dem get di busiest international airport.

Before then, on 31 January 2020, sake of di Covid-19 outbreak inside mainland China and oda kontris across di world, World Health Organization list Nigeria among oda 13 African kontris wey dem identify as high-risk for di spread of the virus.

Skip X post
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of X post

A member of staff works in a laboratory

Wia dis foto come from, AFP

Wetin we call dis foto, Di Institut Pasteur de Dakar, inside Senegal, na one di first laboratories wey fit to test samples ontop dis Coronavirus palava

Last Sunday Nigeria Centre for Disease Control (NCDC) say di test result of suspected coronavirus patient wey dey Enugu State, south east part of di kontri, don commot negative.

NCDC wey be di join-bodi of doctors and specialist wey dey fight di coronavirus for Nigeria on Tuesday night say most pipo wit Covid19 experience mild illness and recover, according to tweet wey dem post.

Protect yourself by handwashing, avoiding contact with sick people and other practices in our public health advisory:,

Last Wednesday, World Health Organization, di ogbonge joinbodi on health mata for world, declare coronavirus as pandemic wey mean say e don dey every where for world.

As at today, according to di Worldometer, na at least 7,988 pipo don die from di virus so far and na at least 198,601 pipo don get di Covid 19 disease for more than 150 kontris.

BBC Pidgin also find out say at least 82,779 around di world don recover.

Di virus, wey dem also know as 2019-nCoV, na new strain of coronavirus wey dem neva see for humans before.