Xenophobia: Air Peace volunteer to carry Nigerians wey wan comot South Africa but who wan go back?

Wia dis foto come from, Instagram/flyairpeace
Some Nigerians wey dey live for South Africa don tell BBC Pidgin say dem no go take up di offer of di free ride to go back dia kontri.
Di Nigerians dey react afta goment announce say Air Peace Airlines don volunteer to send plane go South Africa from Friday September 6, 2019, to bring back kontri pipo wey wish to return home free of charge.
Nigeria goment vow to take action afta di recent attacks against foreigners and Nigerians for South Africa but Prince Obarisiuwa wey dey live and work for South Africa with im family tell BBC Pidgin say im no tink say Nigerians wey dey do legit business for SA go gree return back home.
"Even though dis kain tin dey happun sometimes, Nigerians here dey very comfortable because of di enabling business environment for SA," na wetin Prince tok
"If Nigeria goment fit provide di right environment for business, no nation for di world fit beat us." Na wetin im add put.
"Job go dey for us?"
Anoda Nigerian Lara dey ask goment weda job go dey for dem, if dem come back, or if money go dey for dem to start business.
"No be about free flight wetin goment don prepare for us? If goment put tins im place for us to do we dey ready to come back."
"E no go easy to see pipo wey dey willing to come back to Nigeria." Dat na according to Femi Oshin wey don dey live for South Africa for 15 years.
End of Di one wey oda users dey read well well
"I get two houses and two lands I no fit leave all my investments here come return back to Nigeria. "Oshin tok.
Anoda reason why many Nigerians no go want return home dem don stay here well-well and dem dey very poor dem no go want go back home with empty hand."
Femi say to carry Nigerians comot no be di solution, di solution na for di two kontri goment to sit down find solution to di problem once and for all.

Wia dis foto come from, Getty Images
Since di latest attacks, goments across Africa don react with Nigeria own wey promise say dem go relate with South Africa to stop di attacks once and for all.
On Wednesday, Nigeria boycott di World Economic Forum wey dey happun for South Africa sake of di gbege wey dey ground before dem later announce Air Peace offer to carry kontri pipo for free.
Di statement wey di Foreign Ministry release say: "Di Proprietor of Air Peace Chief Allen Onyema don volunteer to send aircraft from Friday September 6, 2019 to evacuate Nigerians wey wish to return to Nigeria free of charge.
"We dey hereby advise di general public to inform dia relatives for South Africa to take advantage of di offer."
Tok-tok pesin for di ministry Ferdinand Nwonye add say make Nigerians wey dey interested rub mind with di High Commission of Nigeria for Pretoria and di Consulate General of Nigeria for Johannesburg for further arrangements.













