Xenophobia: Nigeria tell South Africa say 'enough is enough'

Pipo wey dey vex for South Africa

Wia dis foto come from, MARCO LONGARI

Wetin we call dis foto, Presido of Nigeria and South Africa bin meet for Japan last week and tok about di attacks. [Dis na old foto of attack on foreigners for South Africa]
Read am in 2 mins

Nigeria say "enough is enough" and say dem go take "serious action" ontop di killing of dia citizens for South Africa.

Foreign Affairs Minister, Geoffrey Onyeama, na im tok dis one on top news of attacks on Nigerians for South Africa.

Im say Nigeria dem don tire to dey receive sad news of how criminals continue to dey burn burn dia pipo house and shop for South Africa and still police no dey provide any protection.

On Sunday, hundreds of South Africans begin fresh attacks, go burn down plus steal properties wey belong to African foreigners for different parts of Johannesburg.

Skip X post
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of X post

Di News Agency of Nigeria say three pipo die and odas wunjure inside di attack.

Xenophobic attack don take di life about 116 Nigerians for South Africa

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Xenophobic attack don take di life of about 116 Nigerians for South Africa since 2016

So far, South Africa police don arrest 43 pipo wey dem say get hand for di attack.

Police bin dey fire teargas, rubber bullet and stun grenade to try stop di tiefs.

E neva clear who dey behind di attacks.

Timeline of attack on Nigerians

Although most attacks wey dey happun for South Africa na on African foreigners, Nigerians dey always follow suffer.

May 2008

Many tori pipo bin describe Johannesburg as "war zone" for dis xenophobia attack wey kill at least 62 come make about 6,000 homeless.

Di mata serious so tey di police say dem arrest more than 200 pipo for crime like murder, rape and robbery.

Na Zimbabwe pipo di attack bin target, but Nigerians bin dey affected for cities like Cape Town.

March 2012

Although violence no enta di mata, South Africa bin apologise to Nigeria say dem deport 125 Nigerians back ontop dia yellow fever certificate wey dem suspect say na fake.

Nigeria bin don accuse South Africa say dia action na xenophobia but dem reject di accuse.

April 2015

For di port city of Durban, violent attack break out, kill at least five foreigners afta Zulu King Goodwill Zwelithini tok say make migrants return to dia kontri - comment wey im later say pipo mistranslate.

Some South African citizens use di king statement to ginger demsef to attack at least 250 foreigners, many from DR Congo. Dem also destroy and tiff from shops wey foreigners bin get.

February 2017

For Pretoria, dem attack 10 houses plus business of Nigerians, di attack happun for several nights.

Di attackers bin also threaten di foreigners for fone to pay protection moni or else dem go destroy dia house.

July 2019

For July 20 South Africans kill one Nigerian.

Di killing make National Association of Nigerian Students to close down South Africa Telecommunications giant , MTN office for Kaduna, north of Nigeria.